You are here: HomeAfricaBBC2023 10 09Article 1859228

BBC Pidgin of Monday, 9 October 2023

Source: BBC

How African leaders react to di kasala between Isreal and Palestine

Di explosion site Di explosion site

More dan 1,100 don die for both sides afta Hamas launch ogbonge attack by Hamas early mor-mor on Saturday.

Rockets still dey fly from Gaza enta southern Israel even afta 36 hours of di first attack.

Israel ansa to air strikes don make 123,000 Palestinians for Gaza to run comot dia house. About 74,000 of those carry demselves go school to find wia to keep head according to di UN.

Hospitals for Gaza don full taya even as dem just dey take light anyhow. Di UN say fuel fit finish for Gaza last power supply source wey be dia power plant in few days.

Di US don carry dia aircraft carrier go close to Israel and say dem go send more weapons.

Dis kain tin na wetin Hamas call "aggression".

US officials dey expect say Israel go launch ground attack enta Gaza within di next two days.

Oil prices don already climb up on Monday sake of worry say di latest events fit don disturb di flow wey dey comot from di Middle East.

Several oda kontris don tok say Hamas don kill or kidnap dia own citizens.

Wetin be African leaders own for dis kasala

African leaders don ask di warring parties for di Israel-Gaza kasala make dem match break.

Di African Union for statement say di kasala burst becos of di "denial of di fundamental rights of di Palestinian pipo, especially dat of a free and sovereign state."

AU commission chair pesin Moussa Faki add say, "di chair pesin urgently beg di two parties to end di military gbasgbos and to go back without conditions to di negotiating table to adapt di principle of two states living side to side, to safeguard di interests of di Palestinian pipo and di Israeli pipo."

Israel bin don ask before to take part for AU meetings as observer wey cause backlash.

Ghana don urge Palestinian Hamas leadership to take immediate action and comot from southern Israel afta dem condemn di attacks on Israel by militants.

For statement wey dem drop on Sunday, di goment of Ghana tell di two parties make dem reduce dia anger and start to dey tok again.

Dem also urge Israel to use restraint for dia response to Hamas attacks.

Nigeria bin warn say, "di cycle of violence and retaliation wey di current kasala go only continue unending cycle of pain and suffering for di civilian pollution wey go carry di load for all di kasala."

Uganda Yoweri Museveni go also call for di warring parties to di "two states solution" for statement on 7 October, wia e say e regret di violence.

Museveni bin host di Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu for 2016 and 2020 to improve di relations hip between di two kontris. Na di Ugandan leader calso arrange normalisations of di relationship between Sudan and Israel for 2020.

But Sudan Ministry of Foreign Affairs don back Palestine as dis new Kasala take start.

For statement wey State news agency Suna post for dia Facebook page, dem say, "Sudan dey follow di dangerous developments wey dey currently happun for occupied Palestine. Sudan dey renew dia support for di legitimate rights for di Palestinian pipo to get dia independent state."

South Africa sef wey don back Palestine historically call for "immediate ceasefire".

Di Department of International Relations and Cooperation (Dirco) post for dia Facebook say, "dis new kasala dey come becos of di continuous illegal occupation of Palestine land, continued settlement expansion, violation of di AL Aqsa mosque and Christian holy sites and di ongoing oppression for di Palestinian pipo."

Kenya President William Ruto don tell di warring parties make dem calm down as "causalities still dey rise".

Zambia Foreign Affairs Minister Stanley Kakubo back Israel for statement wey dem condemn Hamas attacks.

E tok for X say, "we strongly condemn di recent attacks on Israel, wey don lead to los of lives. We without mincing words denounce all acts of aggression and violence and continue to emphasize do need to chase diplomatic means to solve international kasala".

Wetin be Hamas and wetin dey happun for Gaza

Hamas na Palestinian Islamist militant group wey don dey rule di Gaza strip since 2007.

Gaza Strip na a 41km long and 10km wide territory wey dey bordered by Israel, Egypt and di Mediterranean Sea.

E dey house about 2.3 million pipo.

Afta years of kasala wey lead to blockade on Gaza, Hamas don fire thousands of rocket for Israel since Saturday while plenty of fighters don rush enta Israeli territory.