BBC Pidgin of Tuesday, 16 September 2025

Source: BBC

Hollywood icon Robert Redford die at di of age 89

Hollywood icon Robert Redford don die at di age of 89. Hollywood icon Robert Redford don die at di age of 89.

Hollywood icon Robert Redford don die at di age of 89.

Redford die for di early hours of Tuesday 16 September "for Sundance for di mountains of Utah - di place e bin love, and e dey surrounded by dose e love," im publicist confam.

"E go dey greatly missed," Cindi Berger tok, and add say di family dey request for privacy.

Di retired actor wey turn to director star for di movies like Butch Cassidy And The Sundance Kid and All The President's Men.

Redford bin found di Sundance Film Festival, wey dey take place annually for Utah, US, for 1978.

Who be Robert Redford

Robert Redford dey known for im roles for The Sting and Butch Cassidy And The Sundance Kid, and e win Oscar as director.

Dem born am for Los Angeles county, and e begin to appear on stage for di late 1950s, bifor e start television career for 1960 and make im film debut inside War Hunt.

E bin receive Oscar nomination for best actor for im performance for The Sting for 1973.

For 1980, e bin make im directorial debut wit Ordinary People, wey win four Academy Awards, including best picture and best director.

E bin win honorary lifetime achievement Oscar for 2002.

For 2018, e bin announce say di film, The Old Man and The Gun, go be im last onscreen role.

Di icon leave behind im wife Sibylle Szaggars wey im bin marry for 2009, di BBC US partner CBS News report.

E bin previously marry Lola Van Wagenen - di couple bin get four children bifor dem divorce for 1995.

One of dia children, Scott, die at di age of two months from sudden infant death syndrome, CBS report, and James, die of cancer for 2020.

Na two daughters survive am - Shauna, wey be artist, and Amy, wey be director.

Redford bin receive di Presidential Medal of Freedom for 2016, wey US President Barack Obama award to am.

During di presentation ceremony, dem say Redford "art and activism continue to shape our nation cultural heritage, inspiring millions to laugh, cry, tink, and change".

Oda tins wey dem tok about am be say:

"Robert Redford don captivate audiences from both sides of di camera through entertaining motion pictures wey often explore vital social, political, and historical themes.

"Im lifelong advocacy on behalf of preserving our environment go prove as enduring legacy like im pioneering support for independent filmmakers across America."