Di committee wey Ghana health minister Kwabena Mintah Akandoh bin set up to investigate di alleged assault of health workers by social activist Ralph Saint Williams and some youth on 17 August don submit dia report.
Di youth wey carry accident victims to di emergency ward for di hospital dat day tok say di nurses and oda staff delay to attend to dem, na so di social activist begin to do Facebook live video for di emergency ward to rant about di mata.
Dat video bin go viral wey police don chook mouth for di kasala bifor tins calm down dat day.
But some health workers including one rotational nurse - Rejoice Tsotso Bortei bin tok say di youth including di social activist Ralph St. Williams attack her wey dem 'dislocate her shoulder'.
Di Ghana registered nurses and midwives association (grnma) give di police 48 hours say make dem arrest di social activist and oda young pipo wey bin 'storm' di hospital emergency ward dat night, wey di Ridge hospital condemn di attack.
Na so di health minister visit di place wey im assure di health workers say dem go investigate di mata.
Im also confam say police don arrest some of di youth wey storm di facility.
Wetin di committee find afta dia investigation
Di 7-member committee terms of reference na to find di circumstances wey bin lead to di alleged delay in providing care to di patients wey dem carry go di emergency unit and di events wey cause di 'alleged assault' as well as di state of security for di facility.
Di committee bin invite staff, head of department, di social activist and odas for dia investigation.
Dis na some of di tins dem find.
.Di staff neva delay in attending to di patient wit suspected head injury from di accident. But di committee find say all di diagnostic imaging equipment - Xray, CT-scan, MRI for di emergency unit dey faulty wey dem neva dey function. Sake of dis, all di images wey dem demand for di emergency unit, gat to be done outside di hospital; wey bin dey contribute to di delay in starting to care for patients.
.No evidence of physical attack on di nurses. Di committee tok say even though dem get video evidence of tok-tok between di social activist Ralph St Williams and di health workers for di emergency unit, dem no get evidence say di youth attack di staff physically.
No evidence of fracture/ dislocated shoulder of nurse. Informate from di hospital management system say di nurse Rejoice Tsotso Bortei bin report her injuries on her left arm di day afta di incident wey dem bin treat her. But di committee say "we no get evidence of dislocated shoulder joint or fracture of di wrist.
.Security for di hospital dey inadequate. Di committee find say security for di emergency department no dey up to standard. Di facility get only one private security person per every 12-hour shift. Dat na inadequate for hospital wey bin dey receive plenty patients for dia emergency every day.
.Number of nurses and doctors on duty when di incident happun, no dey enough. Seven medical officers and two specialists bin dey available on duty for di month of August for di emergency room permanently. Out of 88 nursing staff wey dem dey work for di emergency unit every month, only 54 currently dey at post; about 34 odas don vacate post without replacement. Dis don cause shortage of nursing staff for di hospital emergency unit.
Wetin di social activist tell di committee
Di committee bin invite di social activist - Ralph St Williams to hear im side of di tori. According to di committee, Ralph explain say im dey frustrated sake of one nurse bin "make provocative remarks" wey bin trigger im anger.
"Im neva physically assault any medical staff wey im neva see say any youth dey attack any staff," di committee tok.
Dem add say di social activist explain say "im neva film any patient intentionally wey im neva target anybody, im only bin film di conduct of di nurses when dem bin allegedly delay to treat di accident victims."
Di committee say di activist don submit four video exhibits togeda wit im Facebook live video as evidence to assist di committee do dia work
Recommendation by di committee
.Di hospital gat to improve dia security for di emergency area; dem gat to add more personnel for di gate and oda places
.Di facility gat to have a police officer for di emergency area 24/7
.Di hospital gat to add more CCTV for monitoring wey e go fit provide evidence for any kind investigation for di future
.Di hospital gat to hire additional clinical staff especially those wia go work for di emergency department
.Di hospital gat to take steps to fix all di imaging equipment (Xray, CT-scan, MRI) sake of di lack of dis don contribute to di delay in providing care by di staff
Association of registered nurses and midwives challenge committee report
Since di incident, di Ghana registered nurses and midwives association bin pressure on top di police and di health ministry to take action against di activist and di youth.
Di rotational nurse wey tok say di youth bin allegedly attack her dat night, bin file GHc7m (4628k) civil lawsuit against di activist Ralph St. Williams for "alleged physical assault and defamation."
"According to di writ of summons wey dem bin file for di high court for Accra on 20 August, Rejoice Bortei bin dey demand Ghc5m ($449k) for battery and GHc2m ($180k) for defamation," local media network citinewsroom bin report.
Di statement of claim allege say St Williams physically assault her wey bin cause injury including dislocated shoulder and hand injury wey don affect her personal duties.
Even tho di committee no find evidence of di dislocation of di shoulder and wrist, di association of nurses maintain say di physical assault don happun.
Di greater Accra regional chairman of di association Jefferson Asare bin challenge aspects of di report.
Im tok say dem bin find say di nurse for di emergency unit "bin dey diagnose wit poly contusion; wey dey refer to multiple bruises wit redness, swelling and pain at di site of di impact."
Oga Asare say di committee findings neva for dismiss di reality of di assault or undermine di credibility of di medical professionals wey attend to di nurse im alleged injuries, im tok channel one TV.
Tok-tok pesin for di nurses for Ridge hospital, Sarah Danquah also tok on top local TV channel GHOne say "we get video of Ralph di activist wey im dey slap one pregnant nurse during di incident, but di investigative committee neva invite us to present am; we go carry dat video give di media."
Meanwhile di police dey continue dia investigation into di mata afta di health minister confam say dem bin arrest some pipo for dia role in di kasala on 17 August.

Di rotational nurse wey tok say dem assault her don file GHc7m ($628k) battery and defamation case for court

Di committee say dem no find evidence of physical attack on nurses for di emergency unit, but di association of nurses maintain say di social activist attack nurses for dia

Di committee recommend say make di hospital beef up security wey dem gatz repair dia imaging equipment wey neva dey work











