You are here: HomeAfricaBBC2023 11 15Article 1881680

BBC Pidgin of Wednesday, 15 November 2023

Source: BBC

Health risk as Nigerians carry TikTok 'Oyinmo challenge' go anoda level

TikTok na very popular social media platform TikTok na very popular social media platform

One new social media challenge wey dare pipo to dey roll for ground don take anoda dimension for Nigera.

Nigerian comedian and artiste, Oderhohwo Joseph wey pipo sabi as Carterefe na im introduce di challenge say make pipo dey roll for ground to compete for di top prize of $1000 to win di “Oyinmo challenge.”

Di challenge na im way of drawing attention to 'Oyinmo' - im latest music video.

For di challenge pipo dey comot dia cloth dey roll for ground inside dirty water den post di video ontop TikTok and Instagram - some of dem dey do am for market inside mud or drain.

Several Nigerian youth don upload dia videos ontop Tik Tok wit di hashtage #OyinmoChallenge to compete for di challenge, as pipo dey begin display different dangerous activitivies wey fit cause health danger and even death inside dia videos.

Di equivalent of di $1000 cash prize na about one million naira for local currency. Dis challenge dey happun for Nigeria at a time wen kontri pipo dey struggle to survive sake of harsh economy.

“I wan start Oyinmo challenge today, I go give $1,000 to three pipo I wan see how spiritual una dey wen you wan worship God becos Oyinmo na Chirstain song. You go thank God as you dey roll for ground I wan see pesin wey go roll pass,” Carterefe tok.

Di comedian wey feem imself show im audience how dem fit join di challenge, as e commot im t-shirt come lie down for ground to begin roll for ground as im dey shout “Oyinmo Imala, na di challenge for $1,000.”

@carterefe Make sure you use the hashtag #oyinmochallenge ❤️

♬ original sound - MACHALA
Concerned Nigerians don express dia worry if pipo begin wunjure or get serious health challenge becos dem join di challenge.

Health expert wey react sake of di trending videos say e dey dangerous to dia health and e fit still cause bacteria, fungi, skin and viral infection for dia body.

Dr Daniel Onyetulem tell BBC Pidgin say mud water get plenty organism wey fit affect pesin health and hygiene.

Di health expert say wen dem jump inside di mud water dem go begin expose dia body to bacteria, fungi or viral base organism wey fit dey inside di water and e go fit cause skin infection.

Dr Onyetulem explain say if dem swallow di water e fit still cause waterborne disease like typhoid fever, trichomonas and hepatitis A and B.

"Health implicatons be say dem fit get deadly infection wey fit affect dia system. E fit even affect dia mental wellbeing becos of di health challenge," Dr Onyetulem tok.

@official_bobo_boy__ OYINMO Challenge