You are here: HomeAfricaBBC2024 05 17Article 1931312

BBC Pidgin of Friday, 17 May 2024

Source: BBC

Hair transplant: How much e cost to get a new head of hairs?

Peter Okoye of di famous PSquare Peter Okoye of di famous PSquare

One video of Nigerian super star musician, Peter Okoye of di famous PSquare don go viral ontop social media wia im dey hospital for Turkey to undergo a hair transplant.

For di video wey im post on im social media handle, Mr P tok say im bin don dey uncomfortable about im hair "but now I wan do something about am".

E later post anoda video as di treatment dey progress, telling im fans say dem don extract 2,400 hairs from im head.

Hair transplants no too dey common for Nigeria, but na fairly regular procedure for Europe and oda parts of di western world.

Reports say, Turkey n aone of di go to destination for pipo wey wan get dia hairs back on a budget. Thousands of visitors from Europe and di Middle East dey flock dia evri month.

Wit more dan 350 clinics in Istanbul alone, di industry dey boom and e worth an estimated $1 billion to di country economy.

How much to get a transplant?

According to di UK National Health Service, "A hair transplant for di UK fit cost anywhere between £1,000 and £30,000, depending on di extent of hair loss, di type of procedure and di clinic wey dey carry am out."

Di number of hair grafts patient dey require dey determine di price di patient go pay. A 700 hair grafts, for instance, fit cost about £1,500 - £3,000. E fit dey higher depending on di surgeon. But a 3000 hair graft go be around £6,500 to £7,000

For Turkey, a 2000 hair graft (Mr P own na 2400) fit cost between £2,000 and £4,500. Again, di prices dey vary depending on di facility and di medical personnel wey handle di procedure.

How di process be?

For 2016, Chris, a 30-year-old database manager from Bradford follow BBC tok about im own hair transplant journey to Turkey also, and e give a clear description of how di process be.

“Initially dem go lie you on your side to inject di anaesthetic into di back of your scalp – I no go say e dey painful, but you go get a good 20 to 30 shots to make sure say you no dey feel anythin.

"Next, dem go start wit di extraction of di follicles. Again, e no be painful process, but hearing and feeling di motorised punch extracting follicles from di back of your head dey a little uncomfortable.

"Afta dat, dem go pad you up and take you away for a light dinner before dem go return for di actual transplant to take place.

"Again, I no feel pain and I fit make out wetin dem bin dey do by di pressure dem dey apply as dem dey insert di new follicles.

"All in all, di surgery bin take about 7 to 8 hours, wey I think say e dey pretty good going by di number of grafts wey I do."

How long bifor you see changes?

Di NHS tok say afta a hair transplant procedure, di surgeon suppose tell you how you go dey look afta your graft. Dem suppose give you a spray wey you go dey use to help recovery and hair growth.

"You need to dey very careful with your transplanted hair for di first two weeks afta your operation, bicos di grafts never dey secure," di advisory tok.

Afta a few weeks, di transplanted hair go fall out, and later start to grow back. After 4 months: new hair go usually start to appear, and afta 10 to 18 months di full result suppose dey clear.

Any side effect?

One of di most common side effects afta a hair transplant, according to di NHS, na:

* a tight, achy and swollen scalp for a few days

* temporary scabbing wia dem transplant di hair (scabbing na dry, rough patch wey dey appear r after wound don heal)

* a single scar or a number of very tiny scars

Also, e dey common wit any type of operation say there fit be small risk of bleeding,

infection, or allergic reaction to di anaesthetic, but di surgeon suppose handle dis ones.

Tiny risk also dey say di transplant fit no take effect and di hairs go just fall out, or noticeable scars go form.

Your Dr go don explain dis tins to you and how im go handle am if e happen.

Celebrities wey do hair transplant

Hair transplantation don help many popular pipo regain dia confidence.

For 2011, Wayne Rooney wey bin dey play for Manchester United tweet say im do hair transplant bicos "I dey go bald at 25".

Im football colleagues bin dey use im bald hair to tease am, and on one occasion Rooney get to remind Michael Owen say talking about im baldness na "sensitive subject".

Also, British comedian Jimmy Carr reveal say im bin do hair transplant, but "e no be like say person donate hair to me. Di surgeons just take hairs from di back of my head come replant dem for di front".


During and after pictures of Chris, who do im own transplant for Turkey in 2016


Former football superstar Wayne Rooney bin reveal say im do hair transplant in 2011