Gunmen don kpai 26 tourists for di Indian-adminstered Kasmir on Tuesday.
Tori be say some of di pipo wey injure for di attack still dey critical condition. Di attack happun for Pahalgam, one Himalayan town wey dey popular bicos of how dia valleys fine.
Part of di pipo wey die na one naval officer wey bin dey dia for im honeymoon, one tech worker, intelligence officer and one local tour guide.
Although tori neva break on top who true-true carry out di attacks, some tori pipo dey say na group wey dey linked to one Pakistan based militant organisation wey dem dey call Lashkar-e-Taiba fit don claim responsibility even though Pakistan don deny say dem no get anytin to do wit di killings.
Prime Minister Narendra Modi sharparly cut im visit to Saudi Arabia come back Delhi sake of di kasala.
Meanwhile, pipo don dey do protest marches around Kashmir bicos of di killings as di region currently dey shutdown.
Kashmir wey both India and Pakistan dey drag don see decades long insurgency against Delhi wey don kpai thousands of pipo, but e dey rare say dem go attack tourists.
Even dis attacks "big pass anytin we don see wey dem even direct give civilians in recent years", na so di region chief minister, Omar Abdullah tok.
Survivors from di attack tok wetin happun, say di kasala burst shortly afta dem comot di torist bus.
One of di woman say di attackers bin dey target men and tok say her husband bin die from one shot to di head, according to di Indian Express newspaper.
Anoda tok about di kasala wey burst as pipo bin dey scream and run afta di first gunshot.
One woman tell di AFP news agency say, "di militants, I no know how many dem be bin comot from di forest near one small meadow and start to dey shoot. E clear say dem bin dey spare men and continue to dey shoot men sometimes one bullet sometimes wit many."
Schools and shops for Kasmir don close in protest for wetin happun for di region even as tori be say di protest move go affect transportation too.
Fears still dey go round say dis attack go affect di amount of pipo wey go dey visit di region for tourism.
Dis na as tori don comot say pipo don dey sharparly cancel dia holiday stay for di region and some tourists for di region don dey already run find way to go back house afta di attack.
Di attack for Pahalgam bin happun as American Vice President JD Vance bin dey India wit im family for four days visit. E bin post about id attacks for X say, "Our thoughts and prayers dey wit dem as dem mourn dis horrific attack".
Oda global leaders wey chook mouth for inside di mata of dis attack.
UN secretary-general Antonio Guterres tok sorry to di victims family say, "attacks against civilians no dey acceptable under any circumstances".
US President Donald Trump say e don follow India Prime minister Narendra Modi tok about wetin happun. E say, "di United Sranst tanda gidigba wit India against terrorism. We pray for di souls wey don go and for di recovery of di pipo wey injure".
Oda leaders like Italian Prime Minister Giorgia Meloni, UK PM Sir Keir Starmer and UAE Minister of Foreign Affairs condemn di attacks.
Who be di victims wey die for di attack?
Families of di victims don dey comot to tok about dia family members.
As at now dis na wetin we sabi:
One of di victims na 47 year old businessman, Manjunath Rao wey bin dey visit di area wit im wife and son and tori be say dem kill am wit single gunshot wound for im head.
Syed Hussain Shah na resident of Kashmir wey im work na to carry tourists on horse rides. Im mama tell ANI new agency say n aim be di only breadwinner ofr di family.
40 year old, Bitan Adhikary na tech worker wey dey work for Florida and come im hometown for di eastern state of West Bengal to see im family earlier in di month.
Shubham Dwivedi bin just marry for February and bin dey visit di resort wit im wife.
26 year old Vinay Narwal na officer for di Indian Navy bin just marry seven days bifor di attack and bin dey visit di meadow wit im new wife.
Manish Ranjan na intelligence officer from di northern state of Bihar and tori say dem shoot am, kill am for di front of im wife and im pikins.
Nepal citizen, Sudip Neupane na student wey go holiday wit im mama, sister and broda-in-law but na only am from im family die for di attack.
As at now, dem don arrange special flights wey go carry di victims deady bodi go dia house. Dis na as dem don already dey transport di pipo from di police kontrol room go di airport for di region main city of Srinagar.
Wetin be di issue wit di region of Kashmir?

Kasala ova Kashmir na di main koko wey dey cause tensions between India and Pakistan. Kashmir na Muslim majority territory for di Himalayas.
Kashmir don also face plenty kasala. In di late 1980s and 1990s, vex ova Indian rule bin lead to insurgency wey kill thousands of pipo. Delhi accuse Pakistan say na dem fund am.
Di Indian administered Kashmir bin get special position for di kontri bicos of one clause for di constitution wey give am beta autonomy.
But for 2019, India comot di privilege status, come divide di state to two federally administered territories – Jammu and Kashmir, and Ladakh.
Di move spoil di relations between two nuclear armed states as Pakistan don reduce ties wit Delhi.

Surviors of di kasala reveal say di attackers bin dey arget men for di shooting