You are here: HomeAfricaBBC2023 12 07Article 1894574

BBC Pidgin of Thursday, 7 December 2023

Source: BBC

Gunmen attack, kidnap students for Nasarawa university community - wetin we know

Students wey dey protest Students wey dey protest

Protest don break out for Lafia, capital of Nasarawa state North Central Nigeria afta armed storm one university community, kidnap some students.

Tori of say bandits kidnap about seven students of Federal University come out on Thursday.

Di attack wey happun on Wednesday night cause anxiety among di students wey don carry protest waka for di town.

Police for Nasarawa state say dem neva get di informate.

"E get wetin happun for one Bar for Gandu yesterday [Wednesday], information no clear as to di victims. So, I no fit tok until I get facts and figures from our men for di area," Ramhan Nansel police spokespesin tok.

Ibrahim Ismaila, president of University utudent union say di attack been happun around 11 pm on Wednesday night, for inside Gandu community.

Ismaila tell BBC News Pidgin say incidents of kidnap na "regular occurence" for di school area and we di students no dey feel safe at all at all".

Di student union leader wey tok how di attack happun say dem bin hear say some bad boys dey harrass some students, dey snatch pipo phones, around "Confidence Lodge".

"We go di wit some security pipo from di school, we also call soja pipo and dem come wit three vehicle, but before we reach, di attackers don run," e tok.

"But for night, I get call say gunmen don enter Gandu, and dem carry about seven students from dia. Di two students wey survive di attack been hide for inside ceiling," di SUG president tok.

"Dis kain tin na wetin dey happun regularly for dis university. Even our State govnor (Abdullahi Sule) bin visit us some weeks ago, and e tok plenty tins wey im go do to stop insecurity for di university. E tok beta beta tins o, but nothing don happun since den, and situation still dey go on."

"Dis matter sef don pass our vice vhancellor, becos im sef don try im best. Even sojas dey come regularly, but diz kidnappers don sabi wen to attack and which routes to follow run."