You are here: HomeAfricaBBC2023 06 11Article 1783940

BBC Pidgin of Sunday, 11 June 2023

Source: BBC

Godwin Emefiele: Tinubu suspend CBN governor

Godwin Emefiele Godwin Emefiele

Nigeria President Bola Tinubu don suspend Godwin Emefiele, afta di ongoing investigation wey dey happun for di governor office and di planned reforms for Nigeria financial sector.

Dem direct di governor of Nigeria highest bank to hand over di affairs of e office to di Deputy Governor (Operations Directorate), wey go act as di Central Bank Governor wit immediate effect.

Dis go depend on di conclusion of di investigation and di reforms.

Mr Emefiele don serve as governor of Nigeria Central Bank since June 2014.