You are here: HomeAfricaBBC2022 10 09Article 1638971

BBC Pidgin of Sunday, 9 October 2022

Source: BBC

Ghana police dey investigate former fetish priestess turned evangelist over alleged money doubling scam 

Nana Agradaa Nana Agradaa

Police for Ghana say dem start dey investigate alleged money doubling scam by one former fetish priestess turned evangelist. De self style evangelist, Patricia Asiedua allegedly talk say she go dash money on Saturday. “Police start dey investigate alleged money doubling scam allegedly perpetrated against some members of de Heaven Way Church for Weija, Accra, by de founder of de church Patricia Asiedua” Ghana Police statelet talk.  Popularly known as Nana Agradaa, de fetish priestess turned evangelist allegedly promise say she go gift about Ghc300,000 to en congregation wey she go double any monies people give her for church.  After people hear dis, dem allegedly carry dia monies give de church in hopes say Nana Agradaa go double am give dem. But on de day wey dem come de church premises to receive double of dia money, she allegedly leave de church without fulfilling her promise.  De disappointed members, inside videos wey dey circulate, some worshippers talk say she scam dem of dia savings, investments and loan monies which dem carry come make she double am.

Repented chief priestess Nana Agradaa who’s now Evangelist Mama Pat is in the news again for using another method of ‘Sika Gari’ to defraud her church members. pic.twitter.com/xgUD1b6q9g— SIKAOFFICIAL???? (@SIKAOFFICIAL1) October 8, 2022