BBC Pidgin of Monday, 8 September 2025

Source: BBC

Ghana host Mali for crucial 2026 world cup qualifier afta Chad setback

Mali go hope to close di gap on Ghana wit a win for dis match Mali go hope to close di gap on Ghana wit a win for dis match

Di Blackstars of Ghana dey face di Eagles of Mali for di second leg of dia 2026 World Cup qualifier for di Accra sports stadium Monday night.

Ghana don dey aim to return to winning form afta dia last game wit Chad wey end in 1-1 draw.

Di Blackstars win di first leg 1-2 for Bamako last year.

Currently di Blackstars dey lead di group wit 16 points only one point above Comoros wey don win dia game 2-0 against Central African Republic on Sunday.

Mali dey fourth wit 12 points from seven games.

Madagascar dey third wit 13 points wey Central African republic dey fifth wit five points.

Chad, di whipping boys for group I, dey bottom wit one point from dia game vs Ghana for N'Djamena.

Ghana dey seek to rebound from di disappointment of di Afcon to qualify for di 2026 World Cup, but afta dem drop points wit Chad, sabi pipo dey tok say dem don complicate tins for diaserf.

Wetin di coaches tok

Fans of di Blackstars don vex well well say Ghana don dash points to Chad; as dem bin dey lead 1-0 wey dem take dia leg of di gas for di Les Sao to score equalizer for di last minute of di game.

Some of di fans and sabi pipo say make dem sack di coach, if he fail to win di game against Mali.

Coach Otto Addo say e dey expect sometin different from im players.

"For dis round, I hope di players don learn from our mistake wit Chad. Di good tin be say we gat our destiny for our own hands," im tok for pre-match press conference.

"We gat to keep di pace high sake of Mali dey good shape now."

"Nobody dey underestimate Mali; everybody sabi say dem good team. We go give everytin and concentrate till di end of di game."

For coach Tom Saintfiet, di Mali team dey Ghana to win dis game.

Di former Gambia coach don send strong message to di Blackstars ahead of di game.

"At dis moment, Ghana dey good position to qualify but we go do everytin to qualify. We go cause upset."

Ghana vs Mali Team news

Villarreal midfielder Thomas Partey miss di game wit Chad sake of illness.

But im train for di last three days wey di coach go hope say im go fit play.

Auxerre midfielder Elisha Owusu go miss di game due to suspension.

Ghana coach bin hand late call up for Real Oviedo midfielder Kwasi Sibo to join di team for camp.

Im dey in line to play some of di game vs Mali.

Fans go hope say Bournemouth striker Antoine Semenyo wey bin miss ogbonge chance for Chad, fit find im scoring boots togeda wit Athletic Club captain Inaki Williams.

Di Blackstars captain Jordan Ayew wey score di goal for Ghana vs Chad go dey important for dis game as well as Tottenham forward Mohammed Kudus.

For Mali, dia three players Nene Dorgeles, Kamory Doumbia and Lassana Coulibaly wey don score for dia 3-0 win vs Comoros go worry Ghana well well.

Di Eagles don show say dem be difficult team to beat; wey dem dey strong for defence.

Na dem get di defence wit di least goals for group I.

Coach Tom Saintfiet dey demand more from Doumbia and El Bilal Toure wey don show good signs.

Tottenham star Yves Bissouma dey miss di game sake of injury.

Head-to-head

Ghana and Mali don meet officially like 11 times wit di Blackstars winning six wey Mali don win three.

Out of di 11 games, Mali team don collect 13 goals.

For World Cup qualifiers, Ghana don meet Mali three times wit di Blackstars winning two wit one draw.

Dis be di form Ghana dey for di World Cup qualifiers (LWWWWD)

Dis be di form for Mali for di qualifiers (DLDDWWW)

Dis na ogbonge game for di two sides; if Mali win, dem go climb to second for di table wit 15 points, one point behind Ghana.

If Ghana win, dem go expand dia lead on top di table to 19 points.

Possible line-ups

Mali

Diarra (GK); Diakite, Niakate, Dante, Nene, Coulibaly, Dieng, Fofana, Doumbia, Traore, Sangare.

Ghana

Asare (GK); Mensah, Salisu, Djiku, Yirenkyi, Partey, Salis, Kudus, Semenyo, Paintsil, Jordan