BBC Pidgin of Friday, 12 December 2025

Source: BBC

Ghana deport Israelis to revenge alleged abuse of Ghanaians

Dem deport di three Israelis from Kotoka International Airport for Accra Dem deport di three Israelis from Kotoka International Airport for Accra

Ghana don deport three Israeli nationals wey arrive di kontri on Wednesday for wetin appear to be do me-I-do you move over di alleged mistreatment of Ghanaian nationals for Ben Gurion International Airport for Israel.

Seven Ghanaians, including four members of official delegation wey go attend one cyber-security conference for Tel Aviv, bin allegedly dey detained without explanation.

Dem release dem afta five hours, while dem deport three odas, according to Ghana, wey condemn dia "humiliating treatment".

Ghana foreign ministry say dem summon a senior diplomat from di Israeli embassy for Accra over di incident, and both kontris don agree to resolve di quarrel amicably.

Ghana foreign ministry note say di two kontris don enjoy decades of friendly relations, wey make Israel alleged actions inconsistent wit dia historic ties.

''Di Govment of Ghana consider di actions of di Israeli authorities to unfairly target Ghanaian travellers and convey di strong reservations against di humiliating treatment of our citizens,'' e tok.

E add say Ghana "expect our citizens to dey treated with dignity and respect in di same way as oda govments go expect Ghana to treat dia nationals".

Di source of di tensions between Ghana and Israel no entirely dey clear, but Ghana recent stance on di Israel-Palestinian conflict fit be a factor.

In September, Ghana bin condemn Israeli air strikes wey hit Qatar, and describe di attacks as a "clear violation of international law" and an affront to Qatar sovereignty. Israel bin target senior Hamas leaders wey bin gada for Qatar capital, Doha.

Di previous month, Ghanaian authorities bin urge Israel to allow more aid into Gaza, and describe di civilian suffering dia as "heart-breaking".

President John Mahama also donate 40 tonnes of Ghana-made chocolate and cocoa products to Palestinians, wey come reaffirm di kontri longstanding support for di Palestinian cause and for a two-state solution to di Israel-Palestinian conflict.

Analysts suggest say all dis actions fit don contribute to di current strained relations, especially if Israel perceive Ghana stance to dey biased or unfavourable.

However, Ghana say dem tell dem say di row dey linked to Israeli accusations say Ghana embassy no dey cooperate over di deportation of dia citizens from Israel.

Ghana insist say dia embassy for Tel Aviv dey "responsive and compliant with international law".