US President Donald Trump don sign a ban on travel to di US from 12 kontris. E cite national security risks, according to di White House.
Di US president say dem fit revise di list if "material improvements" dey and dem fit also add some kontris as "threats emerge around di world".
Dis na di second time Trump go ban travel from certain kontris.
Trump bin sign similar order for 2017, during im first term for office.
Which kontris dey affected?
Trump has signed a proclamation banning travel to the US from nationals of 12 kontris:
.Afghanistan
.Myanmar
.Chad
.
.Republic of the Congo
.
.Equatorial Guinea
.
.Eritrea
.
.Haiti
.
.Iran
.Libya
.Somalia
.Sudan
.Yemen
. E get additional seven kontris wey dia citizens face partial travel restrictions:
.Burundi
.Cuba
.Laos
.Sierra Leone
.Togo
.Turkmenistan
.Venezuela
Why Trump announce travel ban on dis kontris?
Di White House say dis "common sense restrictions" go "protect Americans from dangerous foreign actors".
Inside one video wey e post on im Truth Social website, Trump say di recent alleged terror attack for Boulder, Colorado "underscore extreme dangers" wey foreign nationals wey dem "no properly vet", pose on di US.
Na 12 pipo injure for Colorado on Sunday wen one man attack a group wey bin dey gada in support of Israeli hostages. Di man throw two devices wey dey catch fire and wey dey use makeshift flamethrower.
Di man wey dem accuse say e carry out di attack don dey identified as Egyptian citizen.
Wetin be di exemptions?
E get some pipo from affected kontris wey fit still enta di US sake of di following exemptions:
Athletes wey dey travel for major sporting events, like di 2026 World Cup or di 2028 Olympics.
Holders of "immigrant visas for ethnic and religious minorities wey dey face persecution for Iran".
Afghan nationals wey hold Special Immigrant Visas.
Any "lawful permanent resident" of di US.
Dual nationals wey get citizenship for kontris wey no dey included in di travel ban.
In addition, di Secretary of State fit grant exemptions to individuals on a "case-by-case" basis, if "di individual go serve United States national interest".
Wetin be di reactions to di ban?
Trump latest order, wey dey expected to face legal challenges, draw swift response, at home and abroad.
Somalia promise to work wit di United States to address any security issues.
Inside one statement, Somali ambassador to di US, Dahir Hassan Abdi, say im kontri "value dia longstanding relationship" wit America.
Venezuela Interior Minister Diosdado Cabello warn say "to dey for United States na great risk for anyone, not just for Venezuelans".
Democrats quickly condemn Trump move.
"Dis ban, wey expand from Trump Muslim ban for im first term, go only further isolate us on di world stage," Pramila Jayapal, Democrat congresswoman from Washington, tok for one social media post.
Anoda Democrat, congressman Don Beyer, say Trump "betray" di ideals of di US' founders.
Wetin happun last time?
Trump bin order im original travel ban during im first term for White House for 2017.
E feature some of di same kontris just like im latest order, including Iran, Libya and Somalia.
Critics call am "Muslim ban" as di seven kontris wey bin dey listed bifor na Muslim majority.
Di White House revise di policy and add two non-Muslim majority kontris, North Korea and Venezuela.
Di Supreme Court stamp am for 2018.
President Joe Biden, wey succeed Trump, cancel di ban for 2021, and call am "a stain on our national conscience".











