BBC Pidgin of Thursday, 18 December 2025

Source: BBC

French 'Doctor Death' wey poison patients sentenced to life imprisonment

Frédéric Péchier dey face a minimum of 22 years behind bars Frédéric Péchier dey face a minimum of 22 years behind bars

One court for France don sentence one former anaesthetist to life imprisonment afta dem find am guilty say, e intentionally poison 30 patients, and 12 of dem dey deadly.

Di court sentence 53-year-old Frédéric Péchier on Friday for di end of one four-month trial for di eastern city of Besançon.

Inside one of France biggest ever medical malpractice cases, prosecutors discover say Péchier dey add chemicals like potassium chloride or adrenaline into di infusion bags of patients.

Im youngest victim, na one four-year-old child, wey survive two cardiac arrests during one routine tonsil surgery for 2016. Di oldest victim na 89-year-old.

"You be Doctor Death, a poisoner, a murderer. You bring shame on all doctors," prosecutors tok last week. "You don turn dis clinic to graveyard."

Di chemicals wey Péchier add dey trigger cardiac arrest or haemorrhaging for patients, wey dey need emergency intervention for di operating theatre.

Na Péchier dey carry out di anaesthesia, e go come pose as di patient saviour.

But for di 12 cases wey e no fit intervene, or dey too late, di patient later die.

Di prosecution argue say Péchier bin act dat way to discredit fellow anaesthetists wey e get problem wit.

For most of di operations, no be im be di primary anaesthetist. E dey alleged say e dey come di clinic early to tamper wit di infusion bags.

Den, wen tins go wrong, e go fit step in, tok wetin be di problem and order antidote.

Dem first put Péchier under investigation eight years ago, wen dem suspect say e poison patients for two clinics for Besançon between 2008 and 2017.

Authorities bin raise alert for 2017 afta dem discover one amount of potassium chloride for di infusion bag of one woman wey get heart attack as dem dey operate her for one back complaint.

Investigators discover a pattern of "serious adverse events" for di Saint-Vincent private clinic for Besançon. While di national average for fatal heart attacks under anaesthetic na 1 in 100,000, for di clinic, e pass more dan six in 100,000.

And in most cases nationally, explanation dey later dey for di heart attack, but for Saint-Vincent di mata na mystery.

Dem also discover say di "serious adverse events" end wen Péchier bin comot for a short period to work for anoda clinic, wey also begin witness cases. Den, wen dem return am to Saint-Vincent, di emergencies resume for dia again. Wen dem finally sack am from practising for 2017, di irregularity stop.

Péchier first known victim na 36-year-old Sandra Simard, wen she experience sudden cardiac arrest for di middle of spine surgery.

She survive, thanks to intervention by Péchier, although she bin enta coma.

Tests on her infusion bags bin show concentrations of potassium, wey be 100 times pass di expected dose and authorities sound di alarm wit local prosecutors.

During di15 weeks of di trial, Péchier sometimes dey acknowledge say some of di patients wey fall sick or die fit be sake of di poison, but e deny any wrongdoing.

"I don tok am bifor and I go tok am again: I no be poisoner... I don always uphold di Hippocratic oath," e tok.

Péchier now go spend a minimum of 22 years behind bars, as e dey free throughout di trial.

Péchier bin deny di charges and im lawyers argue say no hard proof dey wey link am to di crimes. But e give different testimony for di trial, and e later confess say e be like poisoner bin dey for di clinic but no be im.

One court psychologist describe Pechier wey be di son of two parents for di medical profession as pesin wey get two personalities – one Dr Jekyll and Mr Hyde personality – one side respectable, di oda side dey capable of doing great harm. In 2014 and again in 2021, e bin make attempts to kill imsef.

Perchier na divorced father of three children, e tell di court bifor di verdict say im only concern na to protect im family.

Im children cry as di judge announce im sentence, but e no shake.

"Na di end of a nightmare," one survivor Sandra Simard tok.

Anoda patient wey survive, Jean-Claude Gandon, say: "We fit get easier Christmas now."