BBC Pidgin of Thursday, 9 October 2025

Source: BBC

Fort Hare University for South Africa shutdown afta student protesters burn school buildings

Di angry students dey demand SRC elections, wey dem wan make dem sack di Vice-Chancellor Di angry students dey demand SRC elections, wey dem wan make dem sack di Vice-Chancellor

Di Fort Hare University for South Africa order di immediate "temporary shutdown" of all dia operations for di Alice and London campus afta dem burn some of di school buildings during protests.

One statement from di Vice-Chancellor and Principal – Professor Sakhela Buhlungu explain why dem order di closure of di school and ask students to "evacuate."

"Dis decision dey difficult afta criminal activities wey connect wit di recent protest dey continue for campus even though di Bhisho High Court give interim order on October 2025 against dis kind activities," di statement tok.

According to di University di court order tok say make di respondents and dia groups neva "engage or promote any unlawful conduct for campus – like to hold meetings during work hours, and tins wey go prevent students and staff from going to class to do dia work."

Di order from di court also tok say make dem no harass, assault or intimidate students or staff wey dem for no destroy university property or even block di road and oda entry points to di university.

Even though di order also prevent pipo from "inciting or participating I any unlawful activities wey go disturb di peace and activities of di university," some students continue wey dem organize di protest wey now destroy university properties.

Di protest follow some changes to di student leadership and management. Di students also dey demand di removal of di Vice-chancellor.

Student leader Asonele Magwaxaza tok SABC say dem "vex wey dem make frustrated about how management dey supress dem."

Videos for social media show plenty smoke from di fire wey burn some of di university buildings.

Di Vice-chancellor announce say di University gat to shut down di school sake of di protest and violence for di campus dey worry academic activities.

Di protest affect many tins for campus

According to di University, di student activities scatter academic work and pipo dey threaten staff and oda students.

Some of di students dey harmed, especially those wey dey stay for campus.

Di statement from di Vice-Chancellor Professor Sakhela Buhlungu also tok say "at least dem burn six significant university buildings for campus."

Earlier dem report say pipo set fire for di buildings – wey some use petrol bomb to attack di main administration building.

"Di student affairs building, di agriculture building and one fresh clinic wey dem plan to open am officially later dis month, all dey affected," university tok-tok pesin JP Roodt explain.

He tok say even though nobody die, di estimate for di tins wey dem destroy for di school go reach R500m ($29.3m).

According to di vice-Chancellor, online academic work go continue even though dem suspend all physical activities until further notice.

All students supposed comot di campus by 17h00 on 09 October 2025.

Dis decision be to prevent more damage to university property and to protect life of students and staff.

Police tok-tok pesin Siphokazi Mawisa say "di situation still dey tense afta students set di school buildings on fire."

The police say dem no arrest anybody yet but di angry students still dey threaten to continue to protest.

School authorities say at least six buildings burn during di protests