You are here: HomeAfricaBBC2024 04 09Article 1925280

BBC Pidgin of Tuesday, 9 April 2024

Source: BBC

Fitz, two odas charged for leaking intimate video of popular Ghana presenter Serwaa Amihere

Ghana TV Presenter Serwaa Amihere and Henry Fitz Ghana TV Presenter Serwaa Amihere and Henry Fitz

Police don charge three pipo for di publication of one intimate video of popular female GhanaianTV presenter, Serwaa Amihere.

Di three chop accuse for di leak of di video for social media last week.

Plenti pipo don dey bash di GHOne TV presenter ova di leak, as all fingers point to one of im ex, Henry Fitz.

For di short video, Serwaa and Henry dey lie on top one bed wey di man dey kiss im neck and im back.

Tori don fly at di time say na di man leak di video afta im blackmail di presenter for many weeks.

Police charge dis three pipo for sharing di video.

Dem be one Edem Saviour Ketti (filmmaker), Candylove Ababio (trader) and Henry Amponsah wey pipo sabi as Henry Fitz (businessman), di main suspect.

Di three don dey face four counts wey dey relate to sexual extortion and di distribution of di intimate video of Serwaa Amihere.

Some of di charges dey include conspiracy to commit crime, wey be non-consensual sharing of intimate images contrary to section 23 of di criminal offences act.

Dem also chop accuse for sexual extortion contrary to section 66 of di kontri cyber security act 2020.

According to court document, one of di three pipo, wey be Henry Fitz dey at large.

Na im many pipo tok say e leak di video afta im blackmail di presenter.

Di police don take di action afta di TV presenter file official complaint ova di video leak.

How di suspects blackmail di presenter

Di suspects don collect Ghc 25k ($1900) from Serwaa but still leak di video.

For di charge sheet, dem tok say di suspects don call di TV presenter im makeup artist on 3 December 2023, “to demand Ghc 5k ($380) odawise dem go leak im nude pictures.”

Na so dem give di makeup artist one mobile number wey get one of di suspects im name (Edem Saviour Ketti) to send di moni.

Di charge sheet tok say for 2 April, 2024, di same pesin don call di presenter wit anoda number to demand additional Ghc 20k ($1500).

Di pesin tok say make she pay di moni in one minute, odawise dem go leak di video.

But afta dem receive di moni, dem still leak di video for social media, according to di charge sheet.

Afta Serwaa Amihere for 3 April file complaint to di police, di service don arrest two of di three suspects.

Di charge sheet tok say Edem Saviour Ketti “admit to say im use im Ghana card to register di number wey dem use to collect di moni from di presenter.”

Police launch manhunt for Henry Fitz, wey be di main suspect for di mata.

Henry na businessman wia dey own some companies including one hotel for eastern region of Ghana.

Tori be say na im and di TV presenter dey inside relationship at a time when Henry don do ogbonge wedding for 2019.

Dat wedding na di tok of social media at di time, sake of Henry hire one pleasure resort for di entire weekend for di exclusive wedding.

Punishment for sharing nudes of oda pipo for Ghana

Sharing nudes and child grooming na crime for one law di kontri pass for 2020.

Based on dis law for di cyber security act 2020, any pesin wey engage in publishing pictures of children or adults go fit face 5, 10 or 25 years in jail.

De law also dey address child grooming for sexual abuse

Pesin wey dey involved for sexual abuse or aiding and abetting or cyber stalking a child go fit land person between 5 to 15 years jail term.

Person wey go share naked images online or on social media platforms go face fine of between $5,200 den $10,000.

Threatening to circulate nude images for cash

In addition to dis, di law make am clear say any person wey go also threaten to send someone nude pics go also face de law.

According to di Cybersecurity laws, threat to circulate nude photos or videos in exchange for cash, dey attract 10 to 25 years in jail.

Willful sharing of nudes

According to Section 278 of the criminal code, pesin wey go publicly and willfully publish dia own nudes, commit grossly indecent act wey be misdemeanor.