BBC Pidgin of Friday, 22 August 2025

Source: BBC

Empty booths and oda highlights for Ticad 9 wey Tinubu dey attend

Nigeria govment booth for di ongoing 9th Tokyo International Conference for African Development (TICAD9) for Yokohama, Japan officially open on Thursday, 21 August, di second day of di summit.

One of di tok-tok pesin to Nigeria President, Dayo Olusegun tweet on X say di kontri booth for TICAD9 now dey buzz wit activity, e don officially open and dey welcome Japanese investors as officials engage wit dia enquiries and explore fresh opportunities for trade and partnership.

Earlier Bayo Onanuga, one of President Bola Tinubu media pesin bin say di booth go become fully operational and serve di delegates wey dey attend Ticad on Thursday.

Im announcement bin come afta some Nigerians wey dey attend di ongoing conference wey start for Wednesday, 20 August para say Nigeria booth dey empty, and no govment official dey ground to receive investors for dat kain important conference.