X owner, Elon Musk don bicom di first pesin for world wey im net worth to grow reach 600 billion dollars.
Dis na according to tori wey di Forbes Magazine publish.
According to di report di growth na sake of di growth of di valuation of im rocket maker company wey im call Space X.
Dis na afta Space X bin launch tender offer wey value di company at $800 billion, according to wetin Forbes report say two of di company investors tell dem.
E mean say di estimated 42% shares wey im get for Space X don rise by $168 billion to make im net worth to an estimated $677 billion.
Dis go be di first time wey pesin value go go above $600 billion and dem neva even reach value of half a trillion.
Elon Musk currently dey closer to becoming trillionaire dan di chance say e go loose im number one position as di richest man for world.
Dis na as di second pesin for di world richest list dey worth an estimated $252 billion.
Even sef di way Musk don level up im money ova di last five years na sometin to behold.
Na just for October here wey di billionnaire reach di half a trillion dollars cap..
By March 2020, Musk bin dey worth $24.6 billion, by August di same year, di rise in di cost of Tesla shares make am di fith pesin for world to dey worth ova $100 billion.
By January, 2021 e bicom di richest man for world for di first time wen im networth climb to $190 billion.
In nine months, dat is by September 2021, e bicom di third pesin for world to dey worth $200 billion.
E hit di $300 billion milestone by November 2021, $400 billion in December 2024 and $500 billion in October.
Wetin be di list of di top ten richest pipo for world.
Apart from Elon Musk, di oda top nine richest pipo for di world include:
Larry Page wey get net worth of $253 billion. Im claim to wealth na as di CoFounder of Alphabet wey be di company wey own Google.
Larry Ellison na third for list wit im networth at around $235.4 billion. Im claim to wealth na as di Chief Technology Officer and Founder of di company wey dem dey call Oracle and im still own about 40% of di business.
Jeff Bezos wey be di founder of di online sales platform, Amazon dey number four position wit net worth wey reach $235.1 billion.
Sergey Brin na co-founder of Alphabet togeda wit Larry Page and im own network stand at $233.8 billion.
Mark Zuckerberg na di cofounder of Meta, wey di apps Facebook, Instagram, WhatsApp and Threads dey under. E dey worth about $222 billion.
Bernard Arnault & Family na di pipo wey dey behind di major fashion brand wey dem dey call LVMH. Di brand get about 75 businesses inside am wey include Louis Vuitton and Sephora. Bernard Arnault na di Chairman and CEO, LVMH Louis Vuitton Moet Hennessy. Dem dey worth $192.1 billionnaire.
Jensen Huang na di CEO and President of di smart chip company wey dey center of di AI movement, Nvidia. E dey worth 153,2 billion.
Warren Buffet wey dey known as one of di most successful investor of all times na di CEO, Berkshire Hathaway Inc. E dey worth about $140.7 billion
Steve Ballmer dey make im money from sports as e be di owner of di Los Angeles Clippers. E dey worth $145.1 billion.











