You are here: HomeAfricaBBC2021 05 26Article 1270846

BBC Pidgin of Wednesday, 26 May 2021

Source: BBC

Elliot Page post-surgery body photo spark reactions, praise from celebrities and odas

Page say im surgery wia dem comot breast tissue -  be Page say im surgery wia dem comot breast tissue - be "life-saving"

Elliot Page don win praise for posing bare-chest for di first time since she come out as trans for December

One Instagram post wey di actor share show am dey smile while posing inside pool in swimming shorts along with di words #transjoy and #transisbeautiful.

Page, 34, bin describe im top surgery - wia dem comot breast tissue - as "life-saving".

Speaking to Oprah Winfrey last month e say e make am "feel comfortable" in im body "for probably di first time".

The Umbrella Academy star bin tearfully explain why im chest bin bring am di "most joy" in transitioning.

"Na to get out of di shower and di towel around your waist and you dey look at yourself for di mirror and you go just be like, 'There I am'. And I no get di moment wia I dey panick," e tok during di Apple TV interview.

View this post on Instagram

A post shared by @elliotpage


Page Instagram post don already receive over two million likes and plenty supportive celebrity comments as dem dey praise im new appearance.

"Dude I see why you crush me on dat workout!" actor Justin Cornwell comment. "Hot" singer Miley Cyrus tok, along with heart emoji.

The Vampire Diaries' Nina Dobrev say: "You look amazing… and most of all happy." Julianne Moore, wey act with Page for di film Freeheld, write: "Happy summer" with a flame emoji.

The Good Place star Jameela Jamil also post, she tweet say she dey pleased to see Page "thriving".