You are here: HomeAfricaBBC2023 07 30Article 1815029

BBC Pidgin of Sunday, 30 July 2023

Source: BBC

ECOWAS give Niger coup leaders seven days to return power to Bazoum

ECOWAS flags ECOWAS flags

Leaders of di Economic Community of West African States don give Niger coup leaders seven days to restore power to elected president Mohamed Bazoum.

Di ultimatum dey part of di resolutions wey leaders of di West Africa regional bloc ECOWAS agree on during one emergency meeting dem hold for Nigeria capital, Abuja.

Di leaders also order make all land and air borders between ECOWAS kontris and Niger close and dem also put in place "no fly zone" on all commercial flights to and from di kontri.

Dis decision by di Ecowas leaders dey come hours afta Niger coup military officials bin warn both regional and Western powers against military intervention to bring back president Mohammed Bazoum.

ECOWAS say make di leaders of di Niger coup immediately release and reinstate Mohammed Bazoum as president and head of state of di Republic of Niger. Dem also call for di full restoration of constitutional order for di Republic of Niger.