You are here: HomeAfricaBBC2023 11 03Article 1874687

BBC Pidgin of Friday, 3 November 2023

Source: BBC

Doctor, tailor and pikin: Tori of pipo dem kill for Gaza

Some of di faces of people dem kill for Gaza Some of di faces of people dem kill for Gaza

Di death toll for Gaza dey rise as Israel press on with im war against Hamas, following di attacks on 7 October wia dem kill 1,400 pipo for Israel.

Health ministry wey Hamas dey run for Gaza say more dan 9,000 pipo na im dem don kill since di war begin.

Because of safety concerns, na few journalists dey Gaza to document di human cost of di fighting.

But BBC don speak to some families and eyewitnesses wwy don tell us stories of loved ones wey dem don kill in recent days.

Yusof Abu Mousa

With di serious power supply issue for di Gaza Strip, Yusof and im older siblings sister Jury, 13, and nine-year-old brother Hamed bin dey feel lucky.

Dia father, Mohamed Abu Musa, na radiographer for di Nasser hospital for Khan Younis, e bin put solar panels for dia house, so di children fit watch their favourite cartoons on TV.

Dem bin dey in front of di television on 15 October when, dia father says, dia home get hit by Israeli air strike.

Jury and Hamed somehow survive, but Yusof lose im life when di roof of dia house collapse.

Di boy na just seven years old.

Dr Midhat Saidam

On di evening of 15 October, Dr Saidam need to rest. Di 47-year-old surgeon neva leave al-Shifa hospital, for Gaza City for more dan one week.

E bin tell im colleagues say e dey go home for di night. But a few hours later, e die from strike for im home.

"Dis calm, funny and kind-hearted man come back to di hospital di next morning, but as a lifeless body," im colleague Dr Adnan Albursh explain.

Dr Albursh, who don know di surgeon for more dan 20 years, add say im late colleague get nickname "di relentless surgeon" by im colleagues for his dedication to the job.

Nour Yousef al-Kharma

Seventeen-year-old student Nour die on 11 October wen Israeli air strike hit her family home for di town of Deir al-Balah, wey dey 14km south of Gaza City, according to her uncle.

Mohammed al-Kharma say im niece bin wan relocate because of di bombing to stay with relatives elsewhere.

"Her father bin ask her to stay in her house, wey dem bomb di very next morning. Na her fate be dat," e tok.

Nour die alongside her nephew Yazan. Di two bin dey play for dia living room.

Her elder sisters, Ola, and Huda, bin dey prepare breakfast with dia mother, Jamalat, wey survive.

Lurin Azzam Abuhalima

For her last communication with her fiancé Khaled al-Masry, Lurin tok say she dey exhausted from moving from place to place in search of safety from di war.

Di 30-year-old bin just arrive di Nusairat refugee camp, for di centre of di Gaza Strip, to stay with her aunty.

Lurin bin survive two strikes before, including one on 16 October wey destroy di building wia she dey live with her parents.

"She tell me say she wan go shower, pray and rest," Khaled recall.

According to her fiancé wey dey live and work in Cyprus, she dey pray in a room wen dem hit di house wia she bin dey.

"Dem kill her while she dey pray," e tok.

Fekriya Hassan Abdul A'al

Pipo for Gaza City Radwan district wey need women clothing dey head straight to Fekriya Hassan Abdul A'al place to get am.

"I remember wen our house dey full of brides-to-be and bridesmaids wey dey come to my mother place to collect clothes. She dey very talented," Fekriya daughter Nevine tok.

Di 65-year-old tailor lose her life along with two of her siblings, two of her children and two of her grandchildren, after air strike hit di house wey dem dey inside on 23 October.

Mazen and Ahmed Abu Assi

Brothers Mazen, 17 and Ahmed, 13 dey among those wey die by di explosion wey happun for di al-Ahli Hospital on 17 October.

Palestinian officials tok say di blast na due to Israeli air strike. But di Israeli military say na result of failed rocket launch by Palestinian Islamic Jihad -accusation wey di group reject.

Arafat Abu Massi, di father of Mazen and Ahmed, say di two brothers dey "very close to each oda" but dem get very different personalities.

Salam Mema

Salam Mema, na 32-year-old Palestinian journalist, wey lose her life on 10 October wen Israeli air strike hit her house for Jabaliya, for northern Gaza, her friend tell BBC.

Her husband, dia two-year-old daughter Sham and dia seven-year-old son Hadi, and oda members of di family all lose dia lives, leaving dia five-year-old son Ali as di only survivor.

As of 31 October, Salam na one of 31 journalists wey die on both sides, since di Israel-Hamas conflict start.

Safaa Nezar Hassouna

Dis 26-year-old pharmacist lose her life for di air strike in di southern city of Rafah, on 17 October.

She bin dey sleep beside her three-month-old baby girl Elyana, and her husband.

Safaa uncle na retired medical doctor based in di UK. Omar Hassouna tok say her parents manage to survive di strike but dey in shock over her death.

Omar tok say di last time e see im niece na for January, during im holiday for Gaza. "Safaa dey very polite, helpful, and everybody like her.”