You are here: HomeAfricaBBC2023 07 29Article 1814651

BBC Pidgin of Saturday, 29 July 2023

Source: BBC

Di one street-town wia 6000 pipo dey live

Suloszowa na beautiful town for south of Poland. Suloszowa na beautiful town for south of Poland.

If you look am from bird eye, e go be like one long line wey link some set of winding, colourful fields.

But if you look am closer, e go show di houses wey 6,000 pipo dey live for dis beautiful village for province of Malopolska (Lesser Poland), for south of di central European kontri.

Dis "Polish pearl" na Suloszowa, "one village wey pipo dey live for one single street", as di photos wey dem post for social networks and thousands of users put am.

Suloszowa na di Ojcowski National Park, e dey popular for im limestone formations, about 36 km from Kraków.

As you fit see am for di aerial foto, di roofs of Suloszowa hous and buildings stretch for both side of one 9 km long street wey dem dey call Olkuska-Krakowska, one of di streets wey long pass for Poland.

And for dia backyard na dia farmland.

One "good sense of community".

But wetin e dey like to dey live for Suloszowa?

"Good sense of community dey here," Edyta, one local shop owner, tell tori pipo English Daily Mail.

"We get Strawberry Day, wen we all go gada togeda and taste di new crops and play music. And we also get Potato Day, wen we dey do same tin".

But as e be for all small villages, e add, "pipo for Suloszowa also like to dey gossip. And we all sabi each oda.

Among Suloszowa tourist attraction na di Pieskowa Skala Castle wey dey for one street wey in name na Eagles' Nest Road.

Di castle dey on di bank of Suloszowa within di boundaries of di Ojcowski National Park.

Na King Casimir III di Great build am for di 14th century as part of di defense chain of di castles "Eagle Nests".

For road wey lead to Suloszowa you fit also find di 'Hercules' Pole', one 30-metre high limestone column wey rise reach sky.