You are here: HomeAfricaBBC2023 12 07Article 1894538

BBC Pidgin of Thursday, 7 December 2023

Source: BBC

Di different sexual assault accuse on top Diddy head as woman allege gang rape at 17

Sean Sean "Diddy" Combs

Woman number four don comot to accuse Sean "Diddy" Combs of sexual assault.

Di accuse tok say im and two oda pipo bin gang rape am wen she be 17 years.

She reveal say dem bin rush am wit drugs and alcohol and take turns on top her bodi.

Diddy don comot to tok say enough is enough! Say dis woman dey comot to collect money from im hand but dis no go be di first time dem go accuse am.

Four women don come out to accuse am, about three of which dey file under di New York Adult Survivors Act. Di law allow alleged victims of sex crimes to sue afta di statue of limitations don pass. Di law bin end for 24 November.

Dem pass di act sake of say di impact of trauma wey sexual assault survivors dey face fit delay pipo to report am.

Casandra "Cassie" Ventura

R&B artist, Casandra "Cassie" Ventura bin accuse am of rape and sex trafficking but dem reach settlement.

Cassie bin accuse Diddy say she bin dey trapped wit am for ten years for cycle of abuse and violence.

She say di rap producer bin rape and and beat am from wen she dey di age of 16 and e be 37 years old.

Di lawsuit call di music star say e be "serial domestic abuser wey go regularly dey beat Ms Ventura and leave am wit black eyes, wounds and blood."

Before di settlement Oga Combs lawyer reveal say Cassie bin wan collect $30m if not she "go write damaging book about dia relationship".

Diddy lawyer wey im name be Benjamin Brafman say di lawsuit bin "get plenti baseless and outrageous lies".

Afta di settlement bin dey reached e tok say "Mr Combs decision to settle di suit no mean say im denial of di claims na lie. E dey happy say dem get mutual settlement and wish her di best."

Joi Dickerson-Neal

On 23 November, Joi Dickerson-Neal come out to accuse Diddy say e sexually assault am for 1991.

She say during dat time, di rapper drug am "wey make am dey di kain state wia she no fit stand or walk for her own".

Di lawsuit add say e come drive am for wia e dey stay and na for dia e sexually assault am.

Tok-tok pesin for Diddy send statement to di BBC say di allegations bin no dey credible and na "just moni grab and notin else."

Jane Doe 1

Jane Doe 1 na di third woman wey accuse Diddy say im and singer and songwriter Aaron Hall bin do turn by turn to rape am and her friend for either 1990 or 1991.

For di filing, Jane Doe 1 say she and her friend go one event for New York wey record company bin dey host and na dia dem meet Oga Combs amd Oga Hall.

Di woman say di two men bin give di two of dem drinks all night before inviting am back go Oga Hall house wia di woman clam she bin "dey coerced to nack Combs".

Rep pesin for Oga Combs say, "dis na fabricated claims wey dey falsely allege misconduct from ova 30 years ago and wey don dey filed for di last minute.

"E no pass moni grab. Na easy target im be for anonymous accusers wey lie... for financial benefit."

Jane Doe 2

Di fourth woman accuse Sean "Diddy" Combs say im and two oda pipo rape am.

She reveal for her court filing say di rapper bin fly am go im New York studio for 2003.

She say dem give am "plenti drugs and alcohol" before Diddy and di two oda men start to do turn by turn to rape am.

Di woman claim say she bin dey waka in and out of consciousness during di alleged mata and she bin dey di kain pain wey she no fit really stand, and no sabi how she take go back house.

She bin claim say na one of di oda two men wey dey di accuse bin meet am for lounge for Michigan come convince her say make she she fly private jet to meet Diddy.

Inside di accuse dem add say one of di men bin force am to give am oral sex wey make Jane Doe 2 "to choke and dey struggle to breathe."

As dis latest accuse come out, Diddy send statement give BBC say "Enough is enough".

For di statement e add say, "Sickening allegations don dey made on me by pipo wey dey find quick moni. Make I dey clear, I no do any of di yeye tins dem accuse me say I do. I go fight for my name, my family and for di truth."

Dis na as fellow rapper 50 cent don reveal say im get plans to release documentary on weda Diddy bin do wetin dem accuse am say im do.

On top all di lawsuit on am, Diddy don step down as di chairman for TV network wey im follow start.

Revolt don tok for dia social media say im no get "day to day role for di business".