Di number of pipo wey don die from di super typhoon for China don kill at least 17 pipo for Taiwan afta one lake burst, wey cause serious flooding for di east.
Geologists describe am as "tsunami from di mountains".
Di equivalent of Category 5 hurricane, Ragasa na di strongest storm for di world dis year. China don evacuate nearly two million pipo from di southern province of Guangdong sake of di Super Typhoon Ragasa wey dey come closer to wia pipo dey stay.
Heavy rain wey fit dey equivalent to one month rain dey expected to fall on Wednesday for Zhuhai city as dem dey prepare for di "King of Storms", according to wetin our correspondent Laura Bicker dey report.
Di typhoon bin don dey show say e go come as e bin dey around di South China Sea for days, wey bring heavy rain and wind to di Philippines, Taiwan, Hong Kong and southern China
Even as Typhoon Ragasa dey cause kasala for China, different bands of heavy rainfall go kontinu to impact parts of southern China, northern Vietnam, di central Philippines and eastern Taiwan wey currently dey impacted by flood.
Di wet season for dis region dey start from June to October, and much of di annual rainfall na from typhoons and tropical storms.
However, average monthly totals for September dey roughly around 350mm for di region, but di next few days fit bring as much as 450mm.
Di ground dey already saturated well-well. More dan 400mm rain bin fall last week from Tropical Storm Mitag.
Kasala wey di typhoon don cause
One high school for Guangfu township wey dem bin wan use as evacuation centre dey flooded now.
One administrator wey bin dey tasked to help pipo wey dey evacuate say around 15:00 local time on Tuesday, im bin hear say di Matai'an Creek barrier lake bin burst thorough di banks.
"Special flooding warnings and broadcast bin no dey," im tok. Moments later, flood water reach di school.
"Within 10 minutes, di water spread to di campus from di street. Di 400-sqm sports ground dey submerged."
Chairs, tables, refrigerators and even cars bin dey float
"Di tin really shock me. E bin feel like exactly wetin we dey see for TV report of di tsunami afta di 2011 Japan earthquake."
Im tok say officials fit don underestimated di impact of Ragasa - di lake, wey dem bin form afta one landslide two months ago, no breach di bank wen one weaker typhoon hit last month.
"If I bin still dey for street, I for no fit reach higher ground," im tok.
"Plenti objects bin dey float for water. E for hit me or electric for shock me."
Since Tuesday, residents of di Chinese city of Shenzhen close down businesses, schools and transport bin dey suspended as dem bin dey expect Typhoon Ragasa. E neva tey wey di city end di shutdown.
"Typhoon Ragasa don dey weak gradually as dey move away from our city," Shenzhen disaster prevention authority tok for statement.
E add say di city meteorological station don downgrade di typhoon warning from red - di highest level - to yellow.
Shenzhen, wey pipo sabi as China Silicon Valley, na home to di largest tech companies and electronics manufacturers for di kontri.
Many of dem bin tell employees to stay for house as Typhoon Ragasa bin approach China southern coast.

Car wey dey submerged inside flood

Di school administrator shock to see floating vehicles afta di township dey flooded











