You are here: HomeAfricaBBC2024 01 04Article 1907594

BBC Pidgin of Thursday, 4 January 2024

Source: BBC

Di Ghana chef wey dey wan break Guinness world record longest cooking marathon

Abdul-Razak Failatu don dey attempt to break Guinness world record for di longest cooking time Abdul-Razak Failatu don dey attempt to break Guinness world record for di longest cooking time

One female chef for Ghana, Abdul-Razak Failatu don dey attempt to break Guinness world record for di longest cooking time.

Di chef wey im popular name be Faila dey wan break di current record of 119 hours 57 mins wia one Irish chef, Alan Fisher don set for October 2023.

Alan wey do di GWR attempt for Japan, use di effort take spread Irish food and culture for dia.

Before Alan, na Nigerian chef Hilda Baci don dey hold di record of 93 hours 11 minutes afta im attempt create buzz for Africa for June last year.

Hilda say na im use di “cookathon take put Nigeria food for di world map wey im wan inspire young pipo say wetin dem put dia mind, dem go achieve.”

Even before di Ghana chef Faila go start im cookathon on 1 January 2024, one chef im name be Dorcus Mirembe (Mama D) for Uganda don do di same cookathon.

Mama D start im own on 23 December wey im cook for six days wit di time of 144 hours 7 minutes.

Di GWR go now review di evidence wia dem submit and declare if im get di record, but as di world don dey wait, chef Faila for Ghana start im own.

Who be chef Faila

Faila be chef wey get restaurant for Tamale, wey dey di northern region of Ghana.

Na dia she from wey im den im husband don dey work for dia.

Faila be soldier man wife.

Im be women rights advocate wey im also dey do charity work.

Faila also be musician wey release im first single Piibu Piibu for 2016.

Im get two oda songs, Mama and Peacekeeping.

Pipo wey know am don tok say na strong woman wit strong views.

“I wan use dis GWR attempt to put Tamale and Ghana for di world map,” Chef Faila tok before di cookathon.

Im also add say through di attempt, “pipo go know about di local food wey dey dis part of di kontri like tuozaafi, wasawasa, tubaani, fufu, red red among odas.”

Faila also dey prepare some continental dishes.

Wen chef Faila start cooking

On 1 January at midnight wey chef Faila don start di cooking.

She dey hope say im go fit cook for more dan six days to match di 144 hours wey mama D of Uganda don do.

“I wan break di record and set one wey nobody go fit break for long time,” Faila tok.

At di time of filing dis report, chef Faila don cook for 80 hours.

Plenti pipo wey dey di venue don dey eat di food wey im dey prepare.

Di crowd also dey cheer am on wit plenti soldiers from Tamale singing and chanting to support di wife of one of dia own.

Ghana Vice President Dr Mahamudu Bawumia don support di event wia im tok say im get hope say “Faila go make di north and Ghana as a whole proud wit dis attempt.”

Oda celebrities, influencers and public figures don dey pass through to offer dia support, despite say di journey from di south of Ghana to di north where di event dey happun be more than 10 hours by road.

Wetin happun to di food im cook

By di time Faila don reach 80 hours, im cook more dan 62 meals wey im dish out ova 800 plates.

Dem also distribute more dan 200 plates to street pipo and oda needy communities for Tamale.

Dis na wetin Faila im team tok say na “responsibility to our society and di place we don dey do di cookathon.”

For di rest of di days, dem plan say dem go distribute more food to orphanages and di aged.

E no be clear how many more days Faila wan cook afta im reach four days, but wit Uganda chef mama D im 144 hour cookathon, Faila im team say dem wan pass dat mark and open gap for front.

For social media di hashtags #cookathonbyfaila and #failacookathon don dey trend.

Chef Faila be di second female for Ghana wey don dey attempt GWR in di last one month after journalist and media personality Afua Asantewaa Aduonum don trend for im singathon attempt for Accra last week.

Afua dey wait di verdict of di GWR afta im complete 126 hours 52 mins of singing for 5 days for December 2023.

Im don turn national star as di kontri dey celebrate im achievement.

Di Ghana tourism authority don name am tourism ambassador hours afta im end di singathon on 29 December 2023.

Im also throw im support behind Faila “make she make di kontri proud wit woman power.”