BBC Pidgin of Tuesday, 7 October 2025

Source: BBC

Di Army general Madagascar president appoint as Prime Minister to stop di Gen Z protests

Pipo see di general appointment as prime minister as attempt by di president to strengthen im power Pipo see di general appointment as prime minister as attempt by di president to strengthen im power

Madagascar embattled President Andry Rajoelina don appoint one army general as di new prime minister, as way to end di protests wey youths dey ginger against im rule.

E say di kontri need premier wey dey "capable of restoring order and di pipo trust" bifor e announce Gen Ruphin Fortunat Zafisambo to di post.

Dis dey come afta di president bin express fears of a coup attempt. Di general appointment mark significant militarisation of di govment and e be like say Rajoelina dey try secure di army support for period wey heightened tensions de ground.

Di protest movement, wey dey known as Gen Z Mada, don reject Gen Zafisambo appointment, and dem give Oga Rajoelina 48 hours to resign.

Wetin dey spark di protests?

"As long as Rajoelina remain for power, we go continue di struggle," Gen Z Mada tok for inside one statement.

Pressure bin start to build on 19 September, afta di arrest of two leading city politicians, wey bin plan one peaceful demonstration for di capital, Antananarivo, sake of very serious power and water supply problems.

kontri pipo dey experience long hours of no light, no power, and nothing from oda services wey di state-owned utility company, Jirama, dey operate.

Many pipo see di detention of these politicians as attempt to silence legitimate voices, and e lead to public outrage. Civil society groups provoke, and di mata lead to di formation of one youth-led online movement wey dey known as Gen Z Mada.

Di protests however start fully on 25 September and e don since blow up into wider dissatisfaction on top corruption, high unemployment plus di high cost-of-living crisis.

Di protests since don spread beyond Antananarivo, e happun for eight oda cities across di island, and signs no dey say e go end.

Protesters wey dey wave banners, don condemn di blackouts and dem accuse di govment say dem fail to guarantee basic rights.

Activists also blame widespread corruption within di power company for di electricity wahala.

Who be Gen Ruphin Fortunat Zafisambo?

Last week, Rajoelina sack di Prime Minister, Christian Ntsay, wey be civilian, and im entire cabinet as attempt to calm di protesters.

For one declaration for di presidential palace late on Monday, President Rajoelina announce di appointment of Gen Zafisambo, e say di prime minister gatz be "pesin wey dey clean" and wey "ready to save Madagascar".

Gen Zafisambo na di director of di military cabinet for di prime minister office until dis appointment.

Wetin di protesters want?

Di demonstrators neva issue any manifesto but wetin start wit anger ova public services don evolve into broader demands for political change.

Many young pipo wey dey face insecure and poorly paid jobs, don call for di president resignation, dem blame am for di problems wey dem dey face.

On Wednesday, 7 September, di demonstrators for di capital dey wave flags and banners wit di words "Rajoelina out".

One tok-tok pesin for Gen Z Mada tell AFP news agency say dem want make di president step down and "di cleaning up of di National Assembly".

Dem also want make Rajoelina take responsibility for dos wey according to security forces kill.

Some social media users don call for di dissolution of di election commission and di kontri top court.

Last week, UN tok say at least 22 pipo don die and more dan 100 pipo injure for di protests, but di govment reject di figures, dem say di figures na based on "rumours and misinformation".

On Monday, security forces bin clash wit di demonstrators for several cities, as kasala for di Indian Ocean Island enta di third week.

Plenty youths, most of dem university students, bin march from di outskirts of di capital, Antananarivo, go di city centre.

One young man wound and dem don carry am go hospital afta fight-fight wit di security forces wey bin erect barricades, AFP news agency report.

Kasala bin also happun for di southern city of Toliara plus di northern city of Diego Suarez.

Former President Marc Ravalomanana, plus oda opposition leaders, don come out in support of di protesters.

E tell BBC say di biggest problem wit Rajoelina na say "e no dey listen".

Ravalomanana add say di appointment of Gen Zafisambo "no go make any difference", as im sef don dey di prime minister position bifor and im no fit solve di crisis wey hit Madagascar.

E say im dey against military intervention and im no go mind return to di office if di pipo want am to.

Multiple protests don rock Madagascar since di kontri gain independence for 1960, including one mass protests for 2009 wey force Ravalomanana to step down and see Rajoelina come to power.

President Rajoelina don rule di kontri for four years, e later return to power afta di 2018 election. Di protests mark di most significant challenge e don face since im re-election for 2023.

Despite dia natural resources, Madagascar na one of di poorest kontris for di world. 75% of dia pipo dey live below di poverty line, according to di World Bank.

Only about one-third of Madagascar 30 million pipo get access to electricity, according to di International Monetary Fund (IMF).