You are here: HomeAfricaBBC2023 02 17Article 1716401

BBC Pidgin of Friday, 17 February 2023

Source: BBC

Deposit N500,000 and below for your bank - CBN tell Nigerians

Old naira notes Old naira notes

Di Central Bank of Nigeria say bank customers fit deposit dia old N500 and N1000 to dia banks.

But di amount dem go fit deposit to di banks no go pass N500,000 (Five hundred thousand naira).

Tok-tok pesin of di apex bank, Osita Nwasinobi confam dis informate to BBC Pidgin.

Dis informate dey come afta plenty Nigerians gada for di Central Bank offices for dia states to deposit dia old naira notes wey don stop to be legal tender according to di CBN.