You are here: HomeAfricaBBC2023 10 06Article 1857710

BBC Pidgin of Friday, 6 October 2023

Source: BBC

Dem go announce Nobel Peace Prize winner today - Wetin to know

Narges Mohammadi Narges Mohammadi

Dem go announce di 2023 Nobel Peace Prize winner today as di world dey wait for who go clinch dis ogbonge global award.

Dem go announce di winner of di ogbonge award for di “promotion of peace” for di Norwegian Nobel Institute for Oslo.

More dan 350 pipo and groups dey nominated but Nobel Prize no disclose dia names sake of say dem no dey announce names of nominees.

Belief be say women rights campaigners, climate activists and international courts wey dey investigate war crimes go dey among di pipo wey dem fit consider.

Some pipo for betting sites predict say Ukrainian President Volodymyr Zelensky fit win am, but Nobel watchers say e dey unlikely say di prize go go to a leader of a kontri wey dey fight war.

Di names of climate activists Victoria Tauli-Corpuz of di Philippines, Greta Thunberg of Sweden, Juan Carlos Jintiach of Ecuador, and Vanessa Nakate don also dey fly up and down for Oslo.

Anoda belief be say Brazilian tribal leader Raoni Metuktire, wey dey campaign against deforestation and for Indigenous rights and di UN Secretary General Antonio Guterres also dey di nomination list.

Or e fit go to one organisation?

Pipo don also mention say di UN refugee agency, di International Court of Justice, and the International Criminal Court fit win am.

Who don win am before?

Since dem start am for 1901, di Nobel Peace Prize don dey awarded to 110 individuals and 30 organisations.

Dem share last year award between human rights activist Ales Bialiatski, di Ukrainian Center for Civil Liberties, wey dey document alleged war crimes, and Memorial, one rights group wey dem ban for Russia.

Oda past winners include Afghan campaigner Malala Yousafzai, and Abiy Ahmed, di Prime Minister of Ethiopia.

Some organisations don get di award several times. Di International Committee of di Red Cross don win am three times, and di Office of di United Nations High Commissioner for Refugees don win am two times.