BBC Pidgin of Thursday, 11 July 2024
Source: BBC
Pipo for Egypt dey in shock and dem dey vex afta dem find one boy wey dey eight years wey dem murder, dem cut off im hands for crime wey prosecutors say dey related to illegal antiquities (relics and monuments) excavation.
Na di pikin papa Issam Abu al-Wafa see im deadibodi for di agricultural land for Assiut Governorate, Upper Egypt, afta im bin miss from home for four days.
Police don arrest di three brothers wey dey connected to di murder.
Two men bin confess say dem commit di crime to sell di pikin hands to pesin wey want di antiquities, di purpose na to help reach one buried ancient Egyptian treasure for one illegal dig. Na wetin public prosecution tok for statement.
‘Only me sitdown dey cry’
Abu al-Wafa, wey dey work as driver, tell BBC Arabic say, "I still remember all my memories wit my son Mohammed. Anytime I sitdown alone, I cry and I no fit bear di situation.
Im dey always wait for me every day wen I return from work."
Abu Al-Wafa tok say “im no expect anytin bad to happun to Mohammed becos all di villagers sabi am well-well.”
“Di news hit me like thunderbolt wen police investigations conclude say di pipo wey kill my pikin na my cousins wey dey always play wit am and even follow me dey search for am”, im add.
Pipo for Social media dey call for punishment and protection
Di crime make pipo para well well ontop social media.
Many dey call for di murderers to get serious punishment, so dat odas go learn lesson from am.
Odas also beg parents to protect dia children well-well by monitoring di pipo wey dey dem mix wit.
Oda incidents
Crimes like dis don happun in recent years for Egypt.
For September 2021, tori fly upandan by official newspapers say dem bin murder and scata di bodi of one young man for di village for Upper Egypt.
According to local reports, im uncle, aunt and cousins confess say na dem kill am and say dem offer im bodi as a sacrifice to one spirit to open one ancient grave.
For 2023, one man bin rape one girl in front of her father for dia home for Giza Governorate.
Di prosecution den refer di man to trial for Giza Criminal Court.
Di man claim say im bin dey follow di orders of one jinn to open one ancient grave under di house.
Dem bin arrest di father and im die for prison. Di man also die months later days bifor dem give sentence.


