You are here: HomeAfricaBBC2024 04 16Article 1926517

BBC Pidgin of Tuesday, 16 April 2024

Source: BBC

Cubana Chief Priest plead not guilty to Naira abuse charges

Popular socialite Pascal Okechukwu alias Cubana Chief Priest Popular socialite Pascal Okechukwu alias Cubana Chief Priest

Popular socialite Pascal Okechukwu alias Cubana Chief Priest don plead not guilty to di charges wey di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC sama am ova naira abuse.

Cubana Chief priest bin appear for di Federal High Court for Lagos on Wednesday wia im plead not guilty to di charges.

Di court bin also grant am bail wey worth about N10 million wit two sureties.

Wetin happun for court

Cubana Chief priest appear early Wednesday morning for di Federal High Court in Ikoyi.

Im show for court wit im pipo and lawyers as dem waka go di courtroom wia di judge bin deliver di judgment.

Afta di court session wia im plead not guilty and dem grant am bail, Cubana waka from di courtroom go im car in di company of im lawyers.

Im stand beside im lawyer as e dey follow di media tok and im bin also dey greet pipo wey come show am solidarity.


Why EFCC charge Cubana Chief Priest go court?

Nigeria anti-corruption agency, di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don drag popular socialite Pascal Okechukwu alias Cubana Chief Priest go court ova accusation of naira abuse.

EFCC say dem file three count charges against Cubana Chief priest say im dey spray and tamper wit naira for different social event wey im go.

Di popular socialite go appear for court wa im go ansa questions ontop di allegations wey dem sama am.

EFCC tok tok pesin Dele Oyewale tell BBC News Pidgin say dem go arraign Cubana Chief priest for Lagos on wednesday.

"Yes, we dey arraign am for Lagos on Wednesday," Oyewale tok.

For 2022, di EFCC bin arrest Cubana Chief Priest on charges wey border on alleged money laundering and tax fraud.

According to di report wey fly upandan, EFCC gbab am for Lagos airport.

Dem no let pipo for public know about dis sake of pressure from im associates and family, wey say di mata fit complicate conditions for oda wey likely dey connected to di alleged charge.

About 48rs afta, di EFCC free Cubana Chief priest and im post for im Instagram page as im thank im followers wey send am messages.

Who be Cubana Chief Priest?

Cubana Chief Priest wey also call imsef Celebrity barman real name na Pascal Chibuike Okechukwu.

Im na business man wey get big investment for entertainment and showbiz - na im get Club Xhrine for Owerri, Imo state.

Dem born Cubana Chief Priest for Umuhu Okabia, Orsu Local Government Area of Imo state.

Na im be di second son of im parents wey train am for Aba, Abia state wia im learn shoemaking.

Cubana Chief Priest later attend Federal Polytechnic Nekede Owerri, wia im earn im first degree.

For early 2021 im bag degree as Doctorate of Science for Event and Luxury Hospitality Management from European American university - im announce di degree on im Instagram page on Saturday, April 24, 2021.

Pascal Chibuike Okechukwu aka Cubana Chief Priest get wife and children.