You are here: HomeAfricaBBC2023 08 27Article 1832831

BBC Pidgin of Sunday, 27 August 2023

Source: BBC

'Crocodile' Mnangagwa win re-election as Zimbabwe president

Zimbabwe President Emmerson Mnangagwa don win reelection Zimbabwe President Emmerson Mnangagwa don win reelection

Zimbabwe President Emmerson Mnangagwa don win reelection to do second term with 52.6% of di vote, di electoral commission tok.

However, di opposition claim say widespread vote-rigging dey and international observers say di vote fall short of democratic standards.

Oga Mnangagwa na dionly Zimbabwe's third president. One 2017 coup against veteran ruler Robert Mugabe bin put am in charge.

Zimbabweans still face high inflation, poverty and a climate of fear.

When e first become president, dem know Mnangagwa - as "Di Crocodile" for im ruthlessness - promise a new start for im kontri pipo.

But Zimbabwe bin get one of di highest inflation rates for di world last month - prices in July bin jump by 101.3% since di previous year. Unemployment also remain high, with only 25% of Zimbabweans holding formal jobs.

Oga Mnangagwa vow to guarantee human rights also appear hollow, with little changing in dis regard since Oga Mugabe departure.

Critics say di 80-year-old silence dissent and clamp down on di opposition for di run-up to di vote, wey dem widely expect am to win.

Di Zimbabwe Electoral Commission (ZEC) say Oga Mnangagwa main challenger, Citizens' Coalition for Change (CCC) candidate Nelson Chamisa, get 44% of di vote.

Oga Mnangagwa receive more dan 2.3m votes, while Oga Chamisa get 1.9m, according to di ZEC. Voter turnout for di kontri of almost 16m na 69%, di electoral body tok.

Di opposition claim dem rig di vote, but di constitutional court don uphold di result.