Di High Court for Lafia, Nasarawa State, don sentence Oluwatimileyin Ajayi to death by hanging for di death of National Youth Service Corp member Salome Adaidu.
Justice Simon Aboki wey preside ova di case sentence di suspect on Thursday.
Di judgment find Oluwatemileyin Ajayi guilty of killing and dismembering (cutting to piece) di late Salome Adaidu.
Dem bin charge Ajayi wit one count of culpable homicide contrary to Section 221 of di Penal Code of Northern Nigeria wey dey punishable by death.
Di late Salome mama bin tell BBC Pidgin say 'Salome na my husband since my husband die, I want justice for my daughter'
Di suspect Timileyin Ajayi bin plead not guilty for court wen di hearing bin start.
Police bin gbab Timileyin Ajayi wey say e be gospel singer wit Adaidu head on Sunday 12 January near one church for Orozo.
One video wey bin go viral on social media, show as pipo surround Ajayi wen dem gbab am and begin ask am question about di human head of di lady wey be corps member.
Im bin tok say Adaidu na im girlfriend and add say dem don dey date for about one year. But Salome family deny am.
Tori be say Ajayi allegedly murder Salome wen she bin visit am for im house for Papalana axis for New Karshi for Karu local goment area of Nasarawa State.
Police bin parade Timileyin wit di knife and machetes wey im bin allegedly use commit di crime.
'God dey in control of everytin' - Family react to judgement
First born of di Adaidu family, Patience Unekwuojo Adaidu, tell BBC Pidgin afta di judgement for court say "notin fit bring my sister back, but im [Timeleyin] death dey sure, I too sure about im death " she add.
She tell BBC Pidgin say "God dey in control of evritin"
Befor di mata go court, she bin make am clear say "Timileyin no be her [Salome] boyfriend" and add say dem as family no sabi di guy as her boyfriend.
According to Patience, late Salome bin get beta plans for life and her oga for Nicon Insurance bin just register her for one online training wey she dey do evri Saturday.
"Di first time wen dem bin call her to do dis professional course, na so my sister call me dey happy. She no dey spend money anyhow, she get beta plans for her life," Patience add.
Salaome na 24-year-old wey bin dey do her National Youth Service Corps (NYSC), for Nicon Insurance for Abuja, Nigeria capital.
She be di fifth pikin and fifth girl for a family of six.
Di late Salome mama bin tell BBC Pidgin say 'Salome na my husband since my husband die, I want justice for my daughter'
How di mata progress
Afta police arrest am as di main suspect for di murder of late Salome Eleojo Adaidu, dem drag am go court.
Dis na afta di family of Adaidu bin call for justice as dem still dey mourn di tragic and sudden death of dia daughter.
Di High Court of Justice for Lafia, Nasarawa state start di trial of Ajayi before dem adjourn di trial to 17 - 20 March, 2025.
Dem rush di trial afta di judge wey bin preside tok say dem get to rush am sake of national interest.
Ajayi bin plead not guilty to di one count charge of culpable homicide wey dem sama ontop im head.
Ajayi bin show face for di High Court of Justice, Lafia, di Nasarawa State capital wia dem arraign am on Monday 27 January, 2025.
Na Justice Simon Aboki bin preside ontop di case for di hearing.
Channels report say di prosecuting counsel Stanley Nwaforagwu, afta di arraignment, tell tori pipo say "dem properly arraign di defendant, Timileyin Ajayi bifor di High Court of Justice, Lafia on a one-count charge of culpable homicide punishable wit death.
Dem take im plea and im bin plead not guilty to di charge and dem set di date for trial.
Afta di hearing period na on Thursday 27 June wey court sentence am to death by hanging.











