You are here: HomeAfricaBBC2024 04 17Article 1926519

BBC Pidgin of Wednesday, 17 April 2024

Source: BBC

Court order Ganduje to shift as national chairman of APC, oda wahala on top ex-Kano govnor head

Abdullahi Umar Ganduje Abdullahi Umar Ganduje

Kano State High Court don issue ex parte order to confam di suspension of former Abdullahi Umar Ganduje as di National Chairman of di ruling All Progressives Congress (APC) party for Nigeria.

Justice Usman Malam Na'abba make di decision afta Ibrahim Sa'ad file appeal case on behalf of leaders of di political party for Ganduje constituency for Dawakin Tofa local goment for Kano state.

Dis development dey follow di plenty kasala wey wan tear di APC.

Di members of di party wey dem file di case on dia behalf na di – deputy secretary, Laminu Sani and legal advisor to APC, Haladu Gwanjo plus nine oda party members wey bin suspend Ganduje two days ago.

Justice Usman Malam Na’abba wey torchlight di case, grant di ex parte, come order Ganduje to stop to dey call imsef as member of di APC party.

Na'abba also suspend di management committee of di APC party for Kano,say make dem no chook mouth for di decisions of di party leaders wey dey for Ganduje ward, afta two-thirds majority of dem don sign am according to dia constitution.

Di nine APC leaders for Ganduje ward say dem bin decide to suspend Ganduje afta one party member, Ja'afaru Adamu, file petition.

For di petition, Adamu tok about some corruption charges wey dey di former govnor head, come demand make di leaders of di ward torchlight di mata, so dem go fit revive di party value and di effect wey di mata go get on dia di campaign of President Bola Tinubu administration.

Di court decision order Ganduje to stop evri activity wey dey connected wit im post as National Chairman of APC.

Dis one mean say im no go fit to dey involve for activities of di party National Working Committee (NWC).

Justice Na’abba say e dey important for all di pipo wey dey involve for dis mata to maintain di status quo of di suspension until 30 April, wen dem co begin hear di case proper.

“Order dey granted directing all parties… to maintain status quo ante belum… restraining [Ganduje] from parading himself as member of APC or to dey in charge of any affairs of di NWC,” di judge tok.