Udinese goalkeeper and former Nigerian Super Eagles top goalie Maduka Okoye don chop two months ban afta dem investigate am for match-fixing.
Court sanction di Udinese goalkeeper with a two-month ban after dem bin charge am with alleged match-fixing, dem say e bin allegedly allow dem to book am on purpose during one match against Lazio for di 2023-2024 season.
Dem say na after one agreement with one of di bettors; di booking hapun for di 18th minute of di second half of di game for time wasting.
E bin dey face four years suspension but di Italian Football Federation, federal prosecutor office on Tuesday drop all charges of sports fraud against am.
Okoye go begin serve im suspension in August 18, di day Udinese go face Carrarese in di first round of di Coppa Italia (2025-2026) season.
'No sporting offence dey committed' - Udinese
Udinese Calcio don release press statement for dia website, wey tok say di tribunal clear Okoye of sporting offences.
"Di FIGC National Federal Tribunal, meeting today to discuss di referral of Maduka Okoye, rule out any involvement of di player in conduct wey we consider unsporting misconduct, fully accepting di lawyers arguments," di statement tok.
"In di trial, we drop all allegations of alleged unsporting misconduct, and di decision to impose two-month ban na base on di violation of di general principle of fair play (Article 4 of the Federal Sports Justice Code).
"Di club express dia satisfaction wit di player proven complete non-involvement in di infamous match-fixing theory. Di club dey full support Okoye, wey dey wait for di ruling reasons.
"Udinese Calcio reiterate dia full confidence in Maduka proper conduct."
Di statement tok.
About Maduka Okoye
Maduka Emilio Okoye na professional goalkeeper wit Nigeria Super Eagles and Udinese club for Italy. Dem bron am in August 28, 1999 for Düsseldorf in Germany. Im mama na German while im papa na Nigerian.
Okoye papa na from Enugu state in Nigeria. Di 25-year-old bin fully join di Nigeria team in 2019 afta e show im performance during di Nigeria match wit Brazil for 2019.
Di 6ft 6in tall goalkeeper start im career for Germany for Borussia Monchengladbach, e also play for Bayer Leverkusen and Fortuna Dusseldorf before e come move to Italy to join Udinese Calcio in 2023.
E win Sparta Player of di Season award for di 2020-2021 season during im time wit Eredivis and help di Dutch team eighth in di Dutch top flight.
At di age of 18, Okoye bin dey di eye of di den Nigeria Super Eagles coach Gernot Rohr since e play for Germany Fortuna Düsseldorf under-19 team.











