BBC Pidgin of Friday, 29 August 2025

Source: BBC

'Cost of single passport don pass worker salary' - Obi, odas react to increase in prices of international passport

Plenti Nigerians including Peter Obi don react to di new announcement for passport Plenti Nigerians including Peter Obi don react to di new announcement for passport

Plenti Nigerians including former presidential candidate Peter Obi don react to di new announcement wia di federal govment increase di price for international passport.

Di reactions follow di increment wey affect di five and ten years validity, and di 32 and 64 pages passports.

Di latest Henley Passport Index ranking wey dem release for 2025, Nigeria passport move to di 88th spot but still dey among di weakest passport for Africa.

Wen di govment make dis announcement on Thursday 28 August 2025 for, e no go well for plenti Nigerians wey dey see am as more hardship.

Now, Nigerian passport application fees don reach as high as 100,000 naira ($65 US dollars) and 200,000 naira ($130 US dollars) for 32 pages and 64 pages respectively.

Meanwhile, for September 2024, di same 32-page passport wey get 5-year validity cost 50,000 naira, while di 64-page passport for 10 years na 100,000 naira bifor.

Di new passport increment wey go take effect from 1 September don cause kasala as Nigerians dey ask why di international passport price go high pass monthly salary of workers.

Former Labour Party candidate for 2023 presidential election Obi say di increment go put burden and suffer suffer ontop Nigerians.

How Nigerians react to di passport increment

"Di way dis administration dey put burden on di populace iand e show say dem dey disconnect from di pipo and suffer wey dey go on."

"Di International Passport fees for Nigeria don go up to 100,000 naira for 32-page booklet and 200,000 naira for 64 pages. Dis na di increase for just two years."

Obi say di kontri still dey struggle wit dia minimum wage, but now di price of di passport don even high pass salary wey workers dey carry go house for month end.

Nigeria minimum wage na about 70,000 naira ($45 US dollars)wey di federal govment set, but e still get some states wey no dey oay reach dat one.

"Instead make dem make life easier, dis govment dey shift di burden to ordinary Nigerians."

"E dey serious say di price of di international passport dey higher dan wetin workers dey earn per month," Obi write for im X post.

Meanwhile, anoda Nigerian , Tobias Chuz dey concerned say no be even evri states don implement di minimum wage but same Nigerians go pay more for di international passports.

"Minimum wage 70,000 naira wey no even dey implemented evriwia for di kontri and di govment dey charge her citizens for passport."

For di oda hand, Dr Joe Abah, former Director-General of di Bureau of Public Service Reforms in provide context into how Nigeria dey produce international passports.

E say di 'Nigeria passport dey produced abroad', and dose wey dey produce am no go ask wetin be di minimum wage for di kontri be bifor dem go charge.

Dr Abah say wetin Nigerians supposed dey worried about na if di price dey fair to di kontri compared to wetin oda kontris dey pay for dia own passport.

"Di producers no dey ask wetin be di minimum wage for your kontri wen dem wan give you price. Di proper question na, say $65 (100,000 naira) na fair price for ePassport compared to wetin oda kontris charge for similar passport," Dr Abah write wen e dey reply to different kwesions for X.

For Emeka Idioha, anoda Nigerian, e say na di demand for di international passport dey make govment increase di price

"Becos say di demand dey high, na why dem increase am, na business opportunity. But why dem no just increase am by 50%. Di minimum wage don increase to 50%?," Emeka ask as e share im view ontop di increment.

Wetin be di new Nigerian passport application fees

Di new Nigerian passport application fees go only affect passport application wey dem make for Nigeria.

.For di 32-page wit 5-year validity, di new price na 100,000 naira,

.For di 64-page wit 10-year validity, di new price na 200,000 naira.

Meanwhile, for dose outside Nigeria wey dey apply for di Nigerian passport, di application fees no change..

NIS say passport application fees by Nigerians wey dey diaspora dey unchanged at di price of $150 for 32-page wit 5-year validity and $230 for 64-page wit 10-year validity.

How to apply for Nigeria passport

Di website to apply for Nigeria passport na
'passport.immigration.gov.ng', and di following na requirements for pesin wey wan apply for fresh passport, for adult and minor:

.Letter of identification from Local Government/State of origin or residence or National Identity Card.
.
For gvoment employees: Letter of introduction stating Service Number, Length of Service and Designation/Rank.

.Valid staff ID card.

.Completed passport application form.

.Marriage certificate, wia applicable.

.Birth Certificate (pipo wey dem born from December 1992 gatz submit certificate by di National Population Commission).

.Pesin wey no get birth certificate go provide age declaration document endorsed by a Commissioner for Oaths, wit one passport-sized photograph
.
.Acknowledgement Slip and Evidence of Payment.

For minors

.Completed passport application form, wit 1 passport-sized photograph to dey endorsed on di oda side by di consenting parent(s).

.Evidence of Nigerian citizenship of parent(s).

.Birth certificate (certificate must be issued by the National Population.

.Commission for minors wey dem born for Nigeria).

.Letter of consent from either parent.

.Acknowledgement Slip and Evidence of Payment.

.For pikin wey dem adopt, di parent(s) go provide court order and letter of approval from di Ministry of Women and Child Development.



Di Nigerian Minister for Interior Olubunmi Tunji-Ojo don drive some positive changes for passport application process for Nigeria since e take office for August last year