You are here: HomeAfricaBBC2024 05 15Article 1931130

BBC Pidgin of Wednesday, 15 May 2024

Source: BBC

Controversial singer gbege wit police, wetin Portable do dis time

Popular singer Portable wey im real name be Habeeb Okikiola Popular singer Portable wey im real name be Habeeb Okikiola

Commissioner of Police for Lagos go chook eye into di arrest of popular singer Portable wey im real name be Habeeb Okikiola, na so Force PRO Olumuyiwa Adejobi tok.

Oga Adejobi tok say police bin make some observations about di matter and dem don point those tins to di CP.

Tok-tok pesin of police for Lagos Benjamin Hundeyin go discuss dis wit di CP and make sure say dem take necessary steps, e add tok for one social media post .

Police arrest controversial singer, Habeeb Okikiola, wey many sabi as Portable, sake of e allegedly refuse to pay debt wey e owe wen e bin buy G-Wagon from one car dealer for di state.

Tori be say Portable bin pay N13m out of vehicle wey worth N27m, and no gree pay N14m balance sake of complain say di car get fault.

Di car dealer den report di matter to di police wey lead to di arrest of Portable.

Police public relations officer (PPRO) for Lagos, SP Benjamin Hundeyin, bin confam di matter for one social media repost.

Na for Abule Egba area of Lagos, police bin gbab Portable.

For one video wey dey go round for social media, Portable bin jump gate afta policemen bin show am warrant of arrest say make e follow dem.

For anoda video, about four policemen bin dey drag di singer, wit handcuff for one hand dem bin use force carry am enta one vehicle wey dey wait.

As di dragging dey go on, di voice of one female wey later dey curse pipo for background say make di singer enta jejely sake of dem go wunjur am.

Dis no be di first time wey di ‘Zazoo’ singer go try avoid police arrest, For April 2023, e bin chop arrest for hand of Ogun State police.

Afta plenty drama and insult wit di officer wey wan arrest am dat time, Portable later submit imself.

Police bin sama Portable wit five counts charges wey border on assault, obstruction of justice and odas.

Di case bin hold for Ifo Magistrate Court, for Ifo Local goment area of Ogun state.

E bin dey remand for Ilaro Correctional Centre bifor authority release am afta e meet im bail conditions.

Many pipo for social media don fault di way di policemen carry out dia duty during di arrest, dem say di singer suppose dey treated wit respect sake of star wey im be.

Oda times Portable name don trend

Trends and Portable na like five and six as di singer be pesin wey like to express imself anytime im feel like.

For March 2024 Portable bin trend afta e drag popular cross dresser Idris Okuneye aka Bobrisky sake of one award of most well-dressed female wey Bob gbab for one Movie Premiere for Lagos.

Around June 2022, Ogun state police bin order Portable di 'Zazu' crooner to report to dia office or dem go declare am wanted.

Di reason na sake of one trending video wia Portable allegedly order im boys to beat up one boy and give am injury.

For anoda video wey trend around dat time, pipo sight Portable wia e dey do hot argument and almost begin cry. Di short video be like incident wey go lead to fight.

Anoda time na wen di Zazu crooner call out Grammy award winner Burna Boy say e dey copy some of im styles. For im Instagram handle, Portable tell Burna say make dem collabo, say e no go good for di Grammy award winner to rip am off.

Portable dey popular for being outspoken and fit dey careless for some of im comments.

Who be Portable?

Im real name na Habeeb Okikiola, im be rapper, singer and songwriter.

Di self-proclaimed Son of Shaku Shaku, don climb di ranks of di kontri fastest-rising singers.

Di 28 year old musician come from Ogun State, South west Nigeria.

For one video wey im share for im tiktok page, e tok say na Nigeria rap star, Olamide bring am to limelight.

Dem bin also share video of wia im meet wit di Nigeria rap star.

Portable Omolalomi social media following don increase well-well since e release di new single.

Currently, im get miilions of followers on Instagram.