You are here: HomeAfricaBBC2023 12 11Article 1896722

BBC Pidgin of Monday, 11 December 2023

Source: BBC

Children of Iran activist wey dey prison accept her Nobel Peace Prize

Teenage twins of jailed Iranian activist Narges Mohammadi don accept di Nobel Peace Prize for am Teenage twins of jailed Iranian activist Narges Mohammadi don accept di Nobel Peace Prize for am

Di teenage twins of jailed Iranian activist Narges Mohammadi don accept di Nobel Peace Prize on her behalf.

Madam Mohammadi – wey dey serve a 10-year jail term for Tehran – na she win dis year prize for her work fighting against di oppression of women for Iran.

For one speech wey dem smuggle out from prison wey her children read out, she condemn Iran "tyrannical" goment.

"Di Iranian pipo, wit perseverance, go overcome repression and authoritarianism," she tok.

"No doubt am, certainly."

Na on Sunday dem hand out dis ogbonge peace prize for Oslo, along wit oda Nobel prizes for literature, science and economics.

Tori be say e don tey wey Madam Mohammadi don become prominent human rights figure for Iran. Na since 2010, di 51-year-old don become regular customer for prison - in total she don chop arrest 13 times, dem convict her five times, and sentence her to a total of 31 years in prison.

Currently she dey prison for "spreading propaganda".

Her husband, political activist Taghi Rahmani, dey live in exile for Paris wit dia two children, dem neva see one anoda for years.

For speech wey dem smuggle out of Iran wey her 17-year-old children Kiana and Ali Rahmani read for French, Madam Mohammadi say: "I write dis message from behind di high, cold walls of prison."

She praise young Iranians wey she say don "transform di streets and public spaces to place of widespread civil resistance" – she dey refer to di protests wey begin last year sake of di death of Mahsa Amini.

"Di resistance dey alive and di struggle neva weak. Resistance and non-violence na our best strategies – Na di same difficult path wey Iranians dey waka until today, tanks to dia historical consciousness and dia collective will."

Di twins collect di prize - wey include a cheque for 11 million Swedish crowns (about £837,000, or $1m) - for ceremony for Oslo City Hall wey hundreds of guests attend.

One empty chair bin dey di podium between her children, to mark her absence.

On Saturday, Madam Mohammadi husband, Oga Rahmani, tell BBC Hardtalk say im wife bin write letter once to her children wit di hope say "dem go forgive her" as she no dey present to "be mama to dem".

Im say she dey among a group of imprisoned human rights activists "wey dey stand up against di tyranny of di Islamic Republic".

One month ago, na im Madam Mohammadi begin hunger strike for di notorious Evin prison wia dem keep her.

Iran foreign ministry don tok before say di Nobel award dey "biased" and dey in line wit "di interventionist and anti-Iran policies of some European kontris ".

Also on Sunday, dem award Norwegian author Jon Fosse di Nobel Prize for Literature, while three scientists receive di Nobel Prize for Chemistry for dia work to develop wetin dem call quantum dots.

Dis year Nobel Prize for Physics dem give am to Pierre Agostini, Ferenc Krausz and Anne L'Huillier. Dia work bin demonstrate how to create extremely short pulses of light wey fit dey used to capture and study rapid processes inside atoms.