You are here: HomeAfricaBBC2023 12 12Article 1897313

BBC Pidgin of Tuesday, 12 December 2023

Source: BBC

Cardi break up wit offset - Wetin we know

Di couple don marry since 2017 Di couple don marry since 2017

Cardi B don confam her single status and dey hope for "a new beginning" afta she reveal say she don separate from her husband Offset.

For one of her Instagram Live clip wey pop culture account share, Di Bongos rapper bin confess to her fans say: "I don dey single for a minute now... I wan start 2024 fresh."

Dis one mean say di couple fit dey call of dia five-year marriage.

Di Migos rapper Offset neva publicly comment on di separation wit im wife.

Cardi B tell her followers on Sunday night say: "I no know if you guys dey see di clues I bin dey drop, from my lives or from my stories wen I put certain music or find my unfollowings...

"I don dey single for a minute now... I just no sabi how to tell di world."

Di Bodak Yellow rapper add: "I wan start 2024 fresh, open. I no know, I dey curious for a new life, new beginning.

"Yeah I dey excited."

Di announcement dey come afta one denial from Offset afta rapper Blueface accuse am say e get affair wit im ex-partner.

"I no ever tok or touch dat lady," Offset bin tweet.

Di separation also follow reports say di couple unfollow each oda on Instagram last week.

Cardi B and Offset, wey dia legal names na Belcalis and Kiari Cephus, don get up and down relationship since dem marry for 2017.

Both Cardi B and Offset bin confam say dem don go dia separate ways for December 2018, before dem reunite again.

Later for September 2020, report tok say Cardi B bin file for divorce, she bin describe dia marriage as "irretrievably broken".

She call am off afta she get back with her husband.