You are here: HomeAfricaBBC2023 08 08Article 1820906

BBC Pidgin of Tuesday, 8 August 2023

Source: BBC

Candidates rush to check as WAEC withhold over 200 thousand results

Candidates dey check WASSCE results for WAEC Candidates dey check WASSCE results for WAEC

Results of 262, 803 candidates wey write di 2023 West African Senior School Certificate Examination (WASSCE) dey withheld, di council tok.

Di West Afrcian Examination Council (Waec) say di plenty results wey dem dey hold na doz of candidates wey involve for examination malpractice and oda mago-mago.

Di 262, 803 withheld results na out of di 1,613,733 candidates wey sidon write di 2023 exam.

Waec on Monday release results for di 2023 WASSCE wia only di results of 1,476,565 candidates wey represent 91.1% don dey processed while results of 137,168 candidates wey represent 8.5% still dey under processing.

Dem reveal say candidates don begin dey rely so much on ‘expo’ becos say dem no wan read for di examinations.

Di council add say e dey always shock candidates wey enter examination hall say di questions wey dem carry for body enter hall no be wetin dey di question and dem go come dey frustrated.

Di Head of Waec for Nigeria office, Patrick Areghan hama say di body no go gree make any bad pesin spoil dia reputation and future of dia candidates wit examination malpractice.

Im tok say di council go begin dey take serious sanctions against any mago-mago wey dem see for any centre sake of say evri pesin including schools and parents wey dey encourage dis kain tin no dey help di future of di candidates.