You are here: HomeAfricaBBC2021 05 01Article 1248529

BBC Pidgin of Saturday, 1 May 2021

Source: BBC

CBN: International Monetary Transfer Operators wey get licence to operate for Nigeria

Central Bank of Nigeria don give 10 more international money transfer operators license to operate Central Bank of Nigeria don give 10 more international money transfer operators license to operate

Central Bank of Nigeria don give 10 more international money transfer operators license to operate.

Ds additional approval wey di apex bank announce so na part of efforts to boost wetin dem call diaspora remittance.

Diaspora remittance simply mean inflows of foreign currencies from abroad.

Wit dis new licence, e don increase di total number of international money companies wey dey operate for di kontri to 57.

Tori be say in recent times CBN dey come up wit policy wey go encourage inflows of foreign currencies.

CBN Govnor Godwin Emefiele, say dis reforms go support Nigeria economy and help reduce di impact of di COVID-19 pandemic.

Di central bank say all diaspora remittances must go through di deposit money banks rather than mortgage or fintech institutions.

"Since I become di CBN govnor, I don dey hear about di size of diaspora remittances; Some say $20 billion, in fact some say e dey about $30 billion.

Honestly, I dey looking for di $30 billion or $20 billion, I neva see am". Na so oga Emefiele tok.

Wetin be di work of International Money Transfer Operators?

Di International Money Transfer Operators na financial companies.

Dia work na to receive cash and send to pesin wey dey leave for Nigeria or wey dey outside di kontri.

Dem dey also carry out cross-border transfer services for personal purposes wey gatz do wit money transfer services.

Dis money transfer services na for family and for foreign tourists wey dey visit Nigeria.