You are here: HomeAfricaBBC2023 09 27Article 1852106

BBC Pidgin of Wednesday, 27 September 2023

Source: BBC

CAF announce hosts for 2025 & 2027 AFCON

CAF president Patrice Motsepe announce di hosts of Afcon 2025 and 2027 during a ceremony in Cairo CAF president Patrice Motsepe announce di hosts of Afcon 2025 and 2027 during a ceremony in Cairo

Na Morocco go host di 2025 African Cup of Nations (AFCON).

Meanwhile, di 2027 Nations Cup go be joint hosting among three East African kontris - Kenya, Tanzania and Uganda.

Confederation of African Football president, Patrice Motsepe tok as e make di announcement for di hosts for di 2025 & 2027 AFCON.

Dis go be di second time di North African kontri afta dem bin host am for 1988.

Di oda 2025 contenders including Algeria, Zambia and a joint Benin/Nigeria bid - all bin agree to withdraw wey leave Morocco as di only bid.

Dis go now allow Morocco a greater chance of bringing di World Cup to Africa again in 2030 as part of dia joint bid.

Di Afcon 2027 wey go take place for Kenya, Tanzania and Uganda go be di first time Africa men football showpiece go happun for east Africa since 1976 wen Ethiopia host.

Algeria last-minute AFCON decision

Algeria don dey for di running for both di 2025 and 2027 events, but newly-elected president of di Algerian Football Federation (FAF) Walid Sadi for one show for di state TV on Tuesday announce di kontri withdrawal from di bidding process.

E tok say na "new approach to di football development strategy forAlgeria" motivate di move.

Di FAF also tok say dem dey plan to "focus dia effort on reorganisation and revitalisation of football for Algeria".

Dis come leave Morocco, Zambia and joint of Nigeria-Benin bid as di remaining candidates for 2025.

Senegal, Egypt, Botswana plus one combined East African bid from Kenya, Tanzania and Uganda dey run for 2027.

Earlier dis year, defending champions Morocco withdraw from di African Nations Championship (Chan) for Algeria afta dem refuse direct flight by di host nation.

Dat time, Caf president Patrice Motsepe tok say: "We must not chook mouth for wetin dey happun between Algeria and Morocco. Make Caf no ever intervene for politics".

Both kontris boast superb stadia and infrastructure, a football-loving population and dem dey capable of delivering world-class football tournaments.

Members of Caf executive committee go cast dia votes on Wednesday afta dem don study independent appraisals of each bidder.

Difficulties for regional rotation

While Motsepe bin don previously hail di organisational abilities of both Morocco and Algeria, comments wey dem make during dis year CHAN fit don also influence Algeria decision to withdraw.

Di Caf president bin outline one vision for regional rotation of Afcon, e tok say "We no fit dey give di organisation all di time to di same region".

However, several months later, Caf secretary general Veron Mosengo-Omba tok say plenty rotation fit no dey possible always.

"Today, only five or six kontris out of di 54 Caf members fit apply to host (Afcon). Wit time e no go dey possible to change am," e tok.