You are here: HomeAfricaBBC2023 03 17Article 1732691

BBC Pidgin of Friday, 17 March 2023

Source: BBC

Burna Boy go perform ahead of Uefa Champions League final for Turkey

Burna Boy go perform ahead of di Uefa Champions League final for Istanbul Burna Boy go perform ahead of di Uefa Champions League final for Istanbul

Burna Boy go perform ahead of di Uefa Champions League final for Istanbul, Turkey.

Uefa make di announcement on 16 March and tok say di Grammy Award winner go bring im energy and signature soulful vibes to millions of fans ahead of di final wey go shele for Saturday, 10 June.

Burna Boy na ogbonge Nigerian star wey im hit songs include Last Last, Common Person, It’s Plenty, Ye, On The Low and many more.

According to Uefa, Burna Boy go headline di 2023 Uefa Champions League Final Kick Off Show by Pepsi at di Atatürk Olympic Stadium for Istanbul wit oda artistes wey dem go announce soon.

Uefa tok say di UEFA Champions League Final Kick Off Show by Pepsi dey unite music, sport and culture through performance.

"Di UEFA Champions League Final Kick Off Show na significant part of our joint efforts wit Pepsi, providing incredible opportunity to reach new and younger audiences wit some of di biggest names and rising stars for music.

We dey excited to showcase a line-up of talented artists at dis season's final for Istanbul for wetin dey sure to be energetic and memorable performance,” Guy-Laurent Epstein tok. Epstein na UEFA marketing director.