BBC Pidgin of Thursday, 9 October 2025

Source: BBC

Burkina Faso military govment arrest NGO workers for accuse of 'spying'

Burkina Faso govment tok say dem arrest eight members of one Dutch-based humanitarian organisation Burkina Faso govment tok say dem arrest eight members of one Dutch-based humanitarian organisation

Burkina Faso military govment tok say dem don arrest eight members of one Dutch-based humanitarian organisation, wey dem accuse of "spying and treason".

Those wey dem arrest include Frenchman, French-Senegalese woman, Czech man, Malian and four Burkinabe nationals - among dem na di NGO kontri director and deputy.

Di organisation tok say di govment don arrest dem bifor, but dem no report am.

Security Minister Mahamadou Sana allege say di NGO "collect and pass on sensitive security information wey dey detrimental to national security and di interests of Burkina Faso, to foreign powers".

According to di security minister, dose wey dem arrest go appear bifor Burkina Faso Prosecutor on charges wey surround espionage and treason, as e dey in accordance wit di Criminal Code.

Di International NGO Safety Organisation (INSO), wey dey provide safety information to aid workers, don "categorically" deny di allegations.

'We reject di allegations' - INSO

Anthony Neal, one representative of di NGO tell BBC Newsday programme say Burkina Faso kontri director don dey for detention since July, wen dem suspend di organisation.

Na di director dem first arrest bifor dem add di oda seven, wey make am dey up to eight for detention.

"We go kontinue to work towards dia safe and immediate release," Neal tok.

Burkina Faso bin suspend di NGO for 31 July on top allegations say dem dey "collect sensitive data witout authorisation".

On Tuesday, 7 September, di security minister tok say even though dem don ban dem, members of di organisation still continue to dey secretly collect information and hold meetings.

Oga Neal deny di claim, e say dia information-collection activities don end since 31 July, but dia staff still dey for Burkina Faso to deal wit di detention and to meet dia contractual commitments.

One statement wey di organisation issue tok say di information dem dey collect no dey confidential, e say di informate na for di safety of humanitarian workers.

"We categorically reject di allegations regarding our activities for Burkina Faso and we remain determined to do evritin possible to secure di release of all our colleagues."

INSO say dem be humanitarian non-profit organization wey get respect for humanitarian principles and dia work na to monitor and report on security trends for more dan twenty kontris around di world.

"Di Burkinabe authorities dey fully informed of our activities and our mandate. We don dey operate for Burkina Faso since 2019, sake of requests for support from NGOs wey dey present for di kontri, and we dey registered wit di relevant ministries, in accordance wit local legislation."

INSO say Burkina Faso authority bin arrest and detain dia country director, bifor dem come arrest four odas and den three more international staff.

Dem say di Global Director of Programmes wey authorities gbab bin travel enta Burkina Faso so e go fit meet relevant authorities to solve di situations, but dem arrest am join.

"Ova di past three months, we don fully cooperate wit di ongoing investigation by di Burkinabe authorities. On several occasions, we don try engage directly wit di Minister of Security and e offer to address any concerns wey e get about our activities."

Oga Neal say e bin try follow di govment tok to address any misunderstandings or concerns.

E add say safety information dey critical, wit a "record" number of aid workers wey dem don kill dis year around di world.

Burkina Faso military govment wey Capt Ibrahim Traore dey lead seize power inside one coup three years ago, and e get frosty relationship wit Western nations ever since.

In response to one worsening Islamist insurgency, di junta bin stop to dey work wit former colonial power, France, and instead turn to Russia for military assistance.

Human rights groups don since accuse di army of committing abuses against civilians as dem dey tackle militants, dem also accuse dem of cracking down on political dissent and freedom of expression.