BBC Pidgin of Tuesday, 9 December 2025

Source: BBC

Burkina Faso arrest Nigerian soldiers for entering dia airspace without permission

Captain Ibrahim Traoré bi di president of Burkina Faso Captain Ibrahim Traoré bi di president of Burkina Faso

Burkina Faso govment don arrest some Nigerian sojas wey make emergency landing for Bobo-Dioulasso, di second-largest city for Burkina Faso on Monday, 8 December.

Di sojas bin land di kontri inside Nigerian C130 aircraft and e carry two crew members and nine military personnel.

Burkina Faso Territorial Administration Minister Emile Zero wey tok on behalf of di Alliance of Sahel States (AES) for di National state TV tok say di aircraft enta Burkina airspace without authorization.

E say di AES bin launch investigation to comfam di violation.

Meanwhile, di military leaders of di three Sahelian nations of Burkina Faso, Mali, and Niger don condemn di violation.

One joint statement from di Alliance of Sahelian States (AES), wey comprise di three military-led West African nations, warn say dem go meet any future incursions wit neutralization.

Dem also say dem don put dia air defense assets on maximum alert following di incident.

"Di aerial and anti-aircraft defenses of di confederal area dey on maximum alert, and dem dey authorized to neutralize any aircraft wey violate our airspace," di statement read,

Di Nigerian authorities neva comment on di incident.

Dis incident dey come afta Nigeria govment recently confam say dem deploy fighter jets and ground troops to support Benin govment to crush one coup attempt for di kontri.

Di AES nations don cut ties wit Western partners and don withdraw from ECOWAS, may be particularly sensitive to regional security developments, given ECOWAS earlier threat of military intervention for Niger.

Burkina Faso, Mali, and Niger wey dey under military rule, dey grapple wit long-standing jihadist insurgencies.