You are here: HomeAfricaBBC2023 11 23Article 1886267

BBC Pidgin of Thursday, 23 November 2023

Source: BBC

Brazilian butt-lift alias BBL dey safe? Why pipo dey do am

Jay Boogie bin dey on admission for weeks wia dem bin treat her for sepsis and acute kidney injury Jay Boogie bin dey on admission for weeks wia dem bin treat her for sepsis and acute kidney injury

Di Nigerian transgender wey experience health complications afta she do lipo and Brazilian butt-lift don comot for hospital.

Jay Boogie wey im real name na Daniel Nsikan bin dey on admission for weeks wia dem bin treat her for sepsis and acute kidney injury afta her operation.

Curvy girls essentials di hospital wey do di operation tok for inside statement say "We dey happy to share say dem don officially discharge Jay boogie from di hospital wia she bin dey receive treatment, na significant step toward stability."

"As of now no indication for need of kidney transplant," CGE add.

Dis na di latest update CGE give on Jay Boogie health situation.

Di transgender health mata bin trend for social media afta she raise alarm about di complications wey happun afta her surgery.

Bum- bum enlargement surgery - aka Brazilian butt-lift (BBL) – na di fastest-growing cosmetic surgery procedure but also one of di most dangerous.

Many pipo dey ask if BBL dey safe afta Jay Boogie case? di answer of dis kwesion dey inside dis tori.

Wetin happun to Jay Boogie?

Di Nigerian transgender say she develop sepsis and acute kidney injury from di lipo and BBL procedure wey she do for 30 October 2023 for one hospital for Nigeria.

Jay Boogie later come out to say she need kidney transplant afta she claim say her two kidney fail sake of di operation wey she do.

But Curvy girls essentials wia she do di operation for inside statement say dat no be true.

"Im don make good progress wit im kidney recovery and dem no confam say im go need transplant," CGE healthcare tok on.

CGE say dem carry out plenty test on Jay boogie before dem clear am for surgery.

Afta di surgery, CGE say di initial recovery stages bin dey go smoothly before di urine wahala come up unexpectedly.

Dem add say Jay boogie go kotinu to receive necessary follow treatment until im make complete recovery

Sake of her health challenge di transgender bin ask di public for financial assistance as she claim say all her saving don go sake of dis problem.

Wetin be Brazilian butt-lift?

Dem dey use BBLs to make pesin bum-bum to dey bigger, to round well-well or to lift am up too.

Surgeons dey insert silicone-filled implants/or inject fat wey dem collect from oda parts of di body like belly and back to put for di bum-bum to make am big.

Di average cost of BBL for Nigeria na 1.5 million naira upwards dat na about $1,824.66 and dat cost go depend on di Surgeon, di location, di specifications of di patient as well as di facility wia dem dey do am.

"Evri surgery get im own risks and complication" na wetin Dr Egiehiokhin Isiwele wey be consultant plastic surgeon and di national secretary of International Society of Aesthetic Plastic surgery for Nigeria tok.

"For BBL surgery, complication dey reduced for di hands of certified plastic Surgeons", Dr Isiwele tok.

Complication wey dey associated wit BBL fit include fat necrosis, fat embolism and dis fit lead to pulmonary embolism and den death.

"Di technique wey di surgeon dey use to inject di fat, di space wia dem dey inject di fat and di volume of fat dem dey put for di bum-bum all dey important to prevent dis kain complications," Dr Isiwele add put.

She advise kontri pipo wey wan do dis surgery to check di profiles of doctors for Nigeria association of plastic aesthetic and reconstructive surgeons (NAPRAS) website before dem submit dem self for surgery.

For now, data on di number of BBL surgery for di kontri dem still dey gada am.

Why pipo dey do bum- bum?

BBC Pidgin speak to two women wey do dia bum-bum, dem share dia experience.

Tonto Dike: "Who no know before say I no get shape, if I come dey hide am before say I no do, shey na una go still curse me say I do." Di Nollywood actress tok

Tonto say her surgery give her confidence "I no dey wear dress again for house, my house pipo don tire," she add.

"You just dey like yourself, you go just dey happy say na me be dis, see as my shape dey like dat."

She say she no dey shame to tok say she do something for her body.

Di oda woman wey speak to us no gree reveal her identity so we go call her anonymous west for here.

"Based on African mentality, dem neva still accept am, na why I no even wan show my face sef," anonymous west tok.

"Di main tin wey I know like about my body before now na my belle," She add.

"My belle come big sotey if I wear cloth and me we like high waist no so e just dey fold for under," she add put.

"Since I do dis my bum- bum eh, I don change my confidence oh, my confidence now na 110," West tok finish.