Two gunmen wey don kill 16 pipo for Bondi Beach for Sydney Australia don dey reported for local media say dem be 50-year-old Sajid Akram and 24-year-old Naveed.
Dis na afta police name dem say dem be papa and pikin. Di papa die for di scene while dem don carry di pikin go hospital wia e dey for critical condition.
Tori be say di men bin don pledge demselves give do Islamic State group as dem find dia flag for di bonnet of dia motor wey dem carry go di scene of attack.
Di shooting target Jewish pipo wey bin go one Hanukkah event. Di pipo wey die for di attack include one 10 year old girl, one British born rabbi, one retired police officer and one Holocaust survivor.
Reports tok say na 27 pipo don dey hospital from di mata as at right now.
Di parents of one bystander Ahmed al Ahmed wey bin dey feem as e dey fight to comot gun from one of di attackers say dem bin shoot am four to five times for im shoulder.
Prime Minister Anthony Albanese say e go push for tougher gun laws afta di attack, dis na as dem find say, di older attacker bin get gun licence for recreational hunting.
Some of di eyewitnesses reveal as dem carry dia pikin dey run afta shooting start.
BBC follow one eyewitness Barry tok, e say e bin dey di first day of Hanukkah event say e go wit im pikin dem and e fit carry dem entao ne of im frined car bifor dem speed away.
E tok say di two men bin dey on top bridge dey shoot enta di grounds and tok say e bin see bodi for ground.
BBC tori pesin, Tabby Wilson bin report say e hia like 20 bangs but nobodi for wia im dey wey be Bronte Beach bin really fear as dem reason say na fireworks.
Dis go be di deadlinest attack since 35 pipo die for Tasmainia for di hand of one single shooter.
Dat mata bin ginger goment to introduce some of di strictest gun control measures for world wey include gun buyback, increase in checks on owners.
Dis move reduce attacks sotay di mass shooting wey dem don get na just like domestic violence, no be attack for public places.
Who be di victims of of di attack
Di family of British-born Rabbi Eli Schlanger, 41 tell BBC say e dey among di pipo wey die.
Rabbi Schlanger bin help arrange di Hanukkah event for Bondi and bin dey work as assistant rabbi. Na wetin di Jewish organisation Chab wey host di event tok.
Chabad aslo report say member Reven Morrision and di secretary of di Sydney Beth Din wey be Jewish religious institution follow die.
Chabad bin also record di death of pesin wey survive di Holocaust wey dem call Alex Kleytman bin die for di attack.
French foreign minister confam di death of one French citizen, Dan Elkayam for id insident.
Police identify di 10 year old girl wey die for di attack say she be Matilda as her family decide say dem no go tok her last name.
Anoda victim na former policeman and local rugby club voluteer Peter Meagher wey bin dey work as photographer for di Hanukkah event wey bin dey targeted.
Local tori pipo, report di dealth of Tibor Weitzen wey be man for im 70s and follow im wife and gradpikin go di Hanukkah event.
Tori e say e bin die as e bin dey try protect family friend from di bullets but yet di family friend still die.
Officials bin don call for blood to treat pipo wey wunjure and di pipo wey wan donate plenti sotay e crash di blood donations website.
For pipo wey dey go blood banks to donate, BBC tori pesin Tiffanie Turnbull tok say di wait time to donate blood na six hours.
One of di donors wey don alreadi spend two hours for line say e no go comot say, "dis na all we fit do".
Wetin we know about di attackers
50 year old Sajid Akram bin enta Australia for 1998 wit student visa wey e transfer to partner visa for 2001 bifor e come get im resident return visa.
E bin get im firearms licence for recreatinal hunting and bin dey as member of one gun club..
Di first time wey Naveed Akram enta get authorities attention of October 2019 but according to di Australian Prime Minister, dem bin do "assessment wey tok say indiciation bin no dey of any ongoing threat, or threat say e go engage in violence".
Australian tori pipo ABC tok day di reason dem bin torchlight Naveed bifor na sake of say e bin get close ties wit one Sydney based Islamic State (IS) terrorism cell.
Police believe say di gunmen bin prepare for di attack for one short let wey dey like 30 minutes drive from Bondi Beach.
Officers bin go di gunmen family house wey be one hour drive to di scene of di crime.
One of dia former neighbours say wen she see di tori of di shooting, she no believe say na dem.












