You are here: HomeAfricaBBC2024 01 06Article 1908494

BBC Pidgin of Saturday, 6 January 2024

Source: BBC

Bolanle Ninalowo deny di identity of viral sex video

Bolanle Ninalowo alias Makanaki bi popular Nigerian actor Bolanle Ninalowo alias Makanaki bi popular Nigerian actor

Popular Nigerian Actor, Bolanle Ninalowo alias Makanaki don deny one viral video wey dey make di rounds.

Di video bin show one man wey get tattoo wey resemble di actor own, dey masturbate but im face no show.

Some pipo for social media bin allege say di pesin for di viral video na di actor as e get same tattoo wit am.

However, for inside one video wey Oga Ninalowo bin post for im verified Instagram account, e clear am say no be im dey di viral video. "I no be di man!",

"Pipo dey call me about one guy wey dey catch fun, dey do im tin for video wey dey go round, dey enjoy imsef. Guy wey no be Bolanle Ninalowo." E tok.

Di Nigerians actor say im and di guy wey dey di soapy video different, "Tattoo don turn wahala o! I know say di guy get band like me but guys, I respect myself too much to do dat kain tin."

For caption to di post, e tok say although e understand why dem mistake di two of dem togeda, but e say, if you compare di tattoo wey dey dia body, e dey different.

E also say dia complexion and di way dia bodi dey built dey different.

View this post on Instagram

A post shared by Bolanle Ninalowo (@iamnino_b)



Who be Bolanle Ninalowo?

Bolanle Ninalowo wey pipo dey call Makanaki, na Nigerian feem actor, na one of di big and popular actor for Nollywood.

Im dey act both English and Yoruba feems and dey active since 2010.

Na on 7 May 1980 dem born am.

Before Ninalowo join Nigeria feem industry im first work as accountant for one bank for United States of America and one oda bank for Nigeria.

E enta Nigerian movie industry as feem producer and di first feem e make na Rebirth.

Im don win awards sake of di way im dey act feem. One of di awards na di AMVCA im win for 2020

For 2010 im win di Best Revelation of di year award. For 2017 e win Best Supporting Actor of di Year for English feems.

For 2018 e also win Best Actor of di Year - English

Ninalowo and im wife bin separate before dem reconcile again. Dem get two pikin one boy and girl.

Some of di feems Nino don act include Husbands of Lagos, Night Bus to Lagos, 30 years a virgin Breaded Life, Crazy Grannies, 13 Letters and odas.