You are here: HomeAfricaBBC2024 04 12Article 1925712

BBC Pidgin of Friday, 12 April 2024

Source: BBC

Bobrisky sentenced to jail, which prison dem go keep am?

Nigeria celebrity Idris Olanrewaju Okuneye weu pipo sabi as Bobrisky Nigeria celebrity Idris Olanrewaju Okuneye weu pipo sabi as Bobrisky

Court don sentence ogbonge Nigeria celebrity Idris Olanrewaju Okuneye weu pipo sabi as Bobrisky to prison.

Justice Abimbola Awogboro deliver di six-month sentence to ‘Bobrisky’, wey don dey detention since dem first arrest am.

Di court pass di sentence wit no option of fine.

Na on Friday di judge bin give di judgment for di Federal high court for Lagos.

Court bin convict Bobrisky afta im plead guilty to naira abuse.

Na Justice Abimbola Awogboro of di Federal High Court for Ikoyi convict di crossdresser.

Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) bin carry Bobrisky go court ova case of money laundering and spraying of naira notes.

Bobrisky bin appear for court on Friday to face six count charges wey surround money laundering and di abuse of di naira plenti times.

Wen dem read di charges, Bobrisky pleaded guilty to di first four counts bordering on naira abuse.

Bifor di EFCC strike counts fourand six out, dem say Bobrisky dey trade but im no submit a declaration of di activities of im company.

For di number five and six count charges, EFCC say Bobrisky commit offence wey dey contrary to Section 6(1)(a), and Section 19(1) (f) of di Money Laundering (Prevention And Prohibition) Act and punishable under Section 19 (2) (b) of di same Act.

EFCC say Bobrisky get one company wey dem pay about N127.7 million inside and im no submit di activities to di Special Control Unit Against Money Laundering between September 2021 and April 2024.

For di last count charges wey EFCC sama am, Bobrisky no submit di declaration of di activities of im company wen anoda N53 million enta im account again.