You are here: HomeAfricaBBC2023 01 16Article 1696280

BBC Pidgin of Monday, 16 January 2023

Source: BBC

Big Brother Titans show and why e dey cause tok-tok for Nigeria

The house mates in the BB Titans house The house mates in the BB Titans house

Reaction don follow di launch of one new reality TV show, Big Brother Titans wey start on Sunday, 16 January as Nigerians dey worry say e go affect di turnout of young pipo for di February presidential election.

Big Brother Titans na anoda version of di Africa most popular reality show franchise, Big Brother.

Di show dey see housemates from different part of Nigeria and South Africa dey battle to win a grand prize of $100,000 cash as dem try to keep viewers glued to dia TV with actions and drama.

Organisers say di show na di join togeda of two ogbonge shows - BBNaija and BB Mzansi TV reality show.

Meanwhile, as Nigeria elections dey approach, some Nigerians don condemn di show say e go be distraction for youth to actively participate for di upcoming election.

'Big distraction'

Ova time, statistics don show say many young pipo dey watch di BBNaija version of di show and e dey obvious from dia discussion on social media since di show start.

Reports say labour party, wey im supporters na mostly youths, don allege say di new reality show dey targeted to distract Nigerian youths from casting dia votes on di election dates.

For one interview wit tori pipo for Daily Post, Nigerian singer/songwriter, Charles Chukwuemeka Oputa, wey dem popularly sabi as Charly Boy, ask di youths to dey more concerned about wetin dey boda dem.

”I expect young pipo to face wetin dey face dem, Big brother no be wetin dey do us”, im tok.

”Make dem just concentrate on wetin dey face dem, wen dem finish dia voting dem fit face Big Brother. Voting suppose be everybody reality no be Big Brother.” Oga Charlie Boy add.

Addressing di issue, during di launch of Big Brother Titans, one of di host of di show, Ebuka say ”Nigerian youths dey very capable of going out to vote and also coming back to watch anything wey dem wan watch.”

Since di show launch on Sunday, #BBTitans na still di top trend for Nigeria twitter space plus oda social media platforms as pipo dey discuss di show and di housemates.

20 housemates na im dey di show dis year dey battle for di 100 thousand dollars cash prize.

Di show wey start on January 15 go last for three months.

Meet di housemates