You are here: HomeAfricaBBC2024 01 09Article 1909763

BBC Pidgin of Tuesday, 9 January 2024

Source: BBC

Betta Edu: One of di youngest ministers for Tinubu cabinet, her journey to Aso Rock and how she land inside controversy wey make dem suspend her

Betta Edu, na di suspended minister of Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation Betta Edu, na di suspended minister of Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation

Di suspended minister for Humanitarian Affairs and Poverty Alleviation, Betta Edu dey expected to showface for di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) office on Monday.

President Bola Tinubu suspend her and give directive to di Chairman of di EFCC Ola Olukoyede to investigate all financial transactions of di ministry and all MDAs wey dey under her.

She chop suspension barely six months in office sake of alleged diversion of funds wey dem suppose use for social development work.

Local media bin report say na for inside one document wey leak she give instruction for di payment of big money to one private account.

Since den, Edu dey tori for di wrong reasons.

Why Tinubu suspend Betta Edu?

Betta Edu, wey be 36 years old become di first minister under President Bola Tinubu to come under public condemnation for crime wey authorities and court neva confam say she commit.

Reports allege say she give instruction for di payment of one big money to one private account.

But di Accountant General of di federation for statement bin come out to say, dem no pay di said money into di personal account as Betta bin instruct dem for her letter.

Dr Betta Edu na one of di women wey President Bola Tinubu inaugurate as part of im Executive Committee.

Wen dem swear her in about six months ago, her appointment as minister receive commendations as she be one of di youngest aged 36 for di president cabinet.

Her portforlio also dey very sensitive sake of say she go dey work wit youth, men and women, and those wey need urgnt help wey natural or man-made disaster cause.

Profile of Betta Edu and her rise to Aso Rock

Dem born Dr Betta Chimaobim Edu on October 27, 1986, she from Cross-River state, South-South, Nigeria.

Na for London her parents born her, she come back to Nigeria wen she dey eight years wit her four siblings and parents.

She come from a family of five children she be twin - she get twin brother.

She be health policy and management expert wit over twelve years professional experience for building and leading teams.

Education and Early Career

She get her First school leaving Certificate and Common entrance in 1995 from Charles Walker International Nursery and Primary school.

For 2001, she get her West African School Certificate (WAEC) from her secondary school wey be Federal Government Girls College, Calabar.

For 2009, she complete her first degree in Medicine and Surgery (MBBCh) from di University of Calabar, Cross River State, Nigeria.

Na for 2012, She go National Youth Service Corp for Calabar, Cross River State wia she serve as di Chief Medical Director for di Cross River state camp.

Dr. Betta Edu, get several advanced degrees like Post Graduate Diploma in Public Health for Developing Countries from London School of Hygiene & Tropical Medicine, United Kingdom, in 2014.

Master of Science Public Health in Developing Countries from London School of Hygiene & Tropical Medicine, United Kingdom in 2014.

She also be Doctor of Public Health from Texila American University.

She dey develop and implement life-saving health policies and programmes for national and state levels.

For 2013, Cross River State, ministry of health appoint her as di medical officer of health.

She be di youngest serving special adviser for di govnor of Cross River state, Benedict Ayade on community health from 2015-2016.

Di former govnor appoint am as di commissioner for health from December 3, 2019 to March 2022 before she resign go join party politics proper.