You are here: HomeAfricaBBC2023 12 08Article 1895291

BBC Pidgin of Friday, 8 December 2023

Source: BBC

Beauty Queen Mitchel Ihezue dey marry her politician and business man bobo

File foto File foto

Miss Universe Nigeria, Mitchel Ihezue dey marry her business man boo, Prince Nicholas Ukachukwu.

Di 27-year-old beauty Queen bin announce her marriage to Prince Nicholas Ukachukwu afta she bin contest for di Miss Universe Pageant for El Salavador for November.

Tori of dia engagement bin comot on di 1st of December wen she post for her official page, her hand with engagement ring.

She add caption say, "na new month, new season, new beginning, a new page don turn. Na time to write new chapter, na new dawn".

Following dat initial review. di beauty queen reveal her pre-wedding pictures with di Anambra politician.

Who be Mitchel Ihezue?

Ugochi Mitchel Ihezue na beauty queen wey don win plenti crowns for her time.

For 2017, she become di Most Beautiful Girl in Nigeria, she bin dey represent Kebbi state. She also get di Model of di Year for di MBGN pageant.

She later go on for inside dat her reign to become Top Model for di Miss World Pageant. Tori be say she go be di first Nigerian to win for dat category.

For September 2023, she go on to contest for di Miss Universe Nigeria wia she represent Imo State.

She win di competition and go on to El-Salvador for November to compete for di Miss Universe Pageant.

For her profile, Mitchel refer to herself as visual artist and women advocate.

At di end of 2022, she bin get her Masters on Business Administration from di Lagos Business School.

For di same year wey she win MBGN, she bin also graduate from di University of Benin in Fine and Applied Arts.

Who be Prince Nicholas Ukachukwu?

Prince Nicholas Ukachukwu na former House of Representative member.

E bin also try to contest for di seat of govnor for Anambra state, South East Nigeria for 2021.

Di business man lose im wife, Barrister Nnenna Millicent for December 2021 as she bin die for inside car accident.

Dat time, President Muhammadu Buhari bin condole with di family of Prince Nicholas for di loss.

Dis wedding dey come three years afta di passing of im wife.